Marbug: Rwanda reduce number of pipo wey fit attend burial

Marburg virus

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Authorities for Rwandan don reduce di number of pipo wey fit attend burial of victims of Marburg virus.

Dis na sake of say dem dey try to control di outbreak of di disease wey dey jump from one pesin to anoda pesin quick-quick.

So far di virus don kill eight pipo during di first outbreak for Rwanda, and di ministry of health for Rwanda confam di tori on Friday.

Marburg, wey get 88% chance to kill pesin wey catch am, dey di same virus family as Ebola.

E dey spread to human being from fruit bats and den through contact wit bodily fluids of infected individuals.

For di new guidelines to stop di spread of Marburg, di health ministry say make more dan 50 pipo no attend di burial of any pesin wey die from di disease.

Di kontri health minister, Sabin Nsanzimana, say most of di victims na healthcare workers wey dey for di intensive care unit.

So far dem don identify twenty cases since dem confam di outbreak on Friday.

Symptoms of Marburg include fever, muscle pains, diarrhoea, vomiting and, for some cases, pesin fit die sake of extreme blood loss.

So far, dem neva get any specific treatments or vaccine for di virus but World Health Organization say dem try develop some kain blood products, drug and immune therapies.

Rwanda say e dey do serious contact tracing or trying to trace all di pipo wey bin come in contact wit pipo wey get di infection.

Dem say dem dey also do surveillance and testing to help reduce di spread.

So wetin pesin fit do to protect imsef?

Authorities say make everybodi shine eye, wash dia hand wit soap and clean water or sanitiser and report any case wey dem suspect.

But wetin be dis Marburg virus? How you go take sabi di symptoms? And how dangerous e dey?

Wetin be Marburg virus?

Dem bin first trace di Marburg virus to African green monkey

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem bin first trace di Marburg virus to African green monkey

Di first time dem discova Marburg virus na for 1967 afta e infect 31 pipo, kill seven for three outbreaks wey bin happun at di same time for Marburg and Frankfurt for Germany and Belgrade for Serbia.

Na two pipo carry di virus go back Europe afta dem two bin go expeditions for some caves for Uganda.

Dat time, authorities bin trace di virus to Africa green monkey wey dem bin import from Uganda.

But since den, dem don link di virus to oda animals too.

Na mostly pipo wey don spend long time inside cave and mines wey get bats, na dem dey spread am.

In recent years, kontris like Equatorial Guinea, Ghana, Democratic Republic of the Congo, Kenya, South Africa, Uganda, Zimbabwe don also get outbreaks of Marburg virus.

Symptoms of Marburg virus infection

Marburg virus wey dey similar to Ebola dey highly infectious.

Some of im symptoms include fever, muscle pains, diarrhoea, vomiting and, in some cases, death sake of extreme blood loss.

Di virus infection dey suddenly begin wit:

  • fever
  • severe headache
  • muscle pains

Afta dis three symptoms, three days later e go follow wit:

  • watery diarrhoea
  • stomach pain
  • nausea
  • vomiting

According to WHO, 'Di way pipo go take look wen dem reach dis stage, na say dem go resemble "ghost, wit drawn face, eyes wey don sink enter inside, no expression for dia face, and dem go dey look extremely lifeless".

Many pipo go den start to bleed from different parts of dia bodi, and some go die eight to nine days afta dem first fall sick, sake of extreme loss of blood and shock.

Egyptian rousette fruit bat na one main carrier of di virus

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Egyptian rousette fruit bat na one main carrier of di virus

How dangerous e be?

Hundreds of pipo don die from di virus in recent years, and most of dem na for Africa.

According to World Health Organization (WHO), di virus dey kill half of di pipo wey e infect, wit previous outbreaks killing between 24% and 88% of patients.

One outbreak for 2005 wey happun for Angola kill more dan 300 pipo. Di highest recorded death from di virus.

For March 2023 five pipo die for Tanzania, three odas collect treatment, while authorities try trace 161 contacts.

Dis na afta one outbreak occur for Equatorial Guinea for February dat same year. E infect nine pipo, kill three. WHO bin investigate 20 more probable cases for dia.

Oda major outbreaks include:

  • 2022, Ghana: three cases, two deaths
  • 2017, Uganda: three cases, three deaths
  • 2012, Uganda: 15 cases, four deaths
  • 2005, Angola: 374 cases, 329 deaths
  • 1998-2000, DR Congo: 154 cases, 128 deaths
  • 1967, Germany/Serbia: 31 cases, seven deaths

Wetin you fit do to protect yoursef

According to Gavi, one international health organisation, dem advice make pipo for Africa stop to dey chop bushmeat.

Pipo need to avoid contact wit pig for areas wey get di outbreak, WHO tok.

Men wey bin don get Marburg virus, make dem use condom for one year afta dem finish treatment or until dia semen test negative twice, for di virus.

Pipo wey gatz bury pesin wey die of di infection gatz avoid touching di bodi.