Wetin be Executive Orders?

Read am in 4 mins

Executive orders na major tool for any US president wey wan make dia mark on goment policy - and e be like say Donald Trump no go waste any time as im return to di White House.

Im bin dey expected to sign more dan 200 executive actions on Monday. Dis include executive orders, wey go dey mainly legally-binding, plus presidential directives like proclamations, wey no dey legaly binding.

Trump promise order wey go push forward artificial intelligence programmes, form di Department of Goment Efficiency (Doge), make records available wey dey connected to di assassination of John F Kennedy for 1963, direct military to create an Iron Dome missile defence shield and eliminate diversity, equity and inclusion (DEI) policies from di military.

How executive order be?

Dis order fit be dramatic reverses of policy, like Trump approval for construction of two bitterly contested oil pipelines for 2017, or ordinary business, like Barack Obama instructions on half-day closing for goment departments on Christmas Eve 2015.

Di power to give executive orders dey for Article II of US constitution, wey say: "Di executive power go deyvested in a president of United States of America."

Why presidents dey give dem?

Sometimes dem dey make dis order during wartime or to prevent domestic crisis.

For February 1942, President Franklin D Roosevelt sign one executive order wey lead to di creation of detention centres for about 120,000 Japanese Americans.

For 1952 President Harry Truman issue one order wey put steel industry under di control of di goment in attempt to avoid strike.

On im first day for office on 20 January, 2021, Biden sign one order wey begin di process of re-joining di 2015 Paris climate agreement, wey im predecessor Trump bin formally withdrew.

Who fit turn dem?

Executive order must work within di law, and in theory, each one suppose dey "reviewed by Office of Legal Counsel for form and legality". E no dey always happun like dat.

If dem feel say order don comot outside di law, dem fit pass am through legal review.

Congress fit also pass law to override di executive order, but di president still get veto over dat law, di Constitution Centre explain.

Why dem dey politically sensitive?

Executive orders dey controversial becos dem dey bypass approval from Congress, allowing di president to act on im own.

Republicans successfully sue Obama sake of part of im 2010 healthcare changes, arguing say im pass im constitutional authority wen only im one by imsef delay one insurance coverage deadline.

Trump travel ban on some majority-Muslim kontria bin dey highly controversial, and Biden end am as im enta White House.

President also fit issue order wen members of Congress act too slowly or wen di president feel ssay im need to flesh out details of new law.

How often dem dey issue executive orders?

Na Franklin D Roosevelt issue di most orders - 3,721 during im 12 years for office, while Woodrow Wilson and Calvin Coolidge sign 1,803 and 1,203 respectively.

During im former term, im bin sign 220 executive orders, some of dem bin face challenge for court.

In comparison, Joe Biden issue 160 executive orders, and Barack Obama and George W Bush, wey bin both serve two consecutive terms, issue 277 and 291 respectively.

New president fit undo dia predecessor orders?

In recent times, presidents dey increasingly use dia executive orders to undo di work of dia predecessor.

For 2017, Trump begin wit one executive order wey target Obamacare.

Biden revoke Trump administration emergency declaration wey help to fund di building of wall along Mexican border and also end one travel ban on some majority-Muslim kontris.

Im also return di Paris climate agreement.

Now as Trump return for second term, im don swear say im go sign plenty executive orders within moments of im inauguration, covering issues ranging from immigration and deportations to environment and transgender rights.