African trade unions, youth groups and odas for Ghana demonstrate for debt cancellation and trade justice

Read am in 4 mins

Trade unions for Africa, youth groups and odas bin hit di streets of Ghana to demand for debt cancellation for di continent.

Di groups say African kontris dey suffer from huge debts and oda trade systems wey no dey favour di continent

Togeda, African kontris bin get sovereign debts of at least $2.14 trillion wia 22 kontris dey high risk of distress

According to di groups, African kontris bin dey spend all dia moni to pay back loans; na so dia own citizens continue to dey poor wey infrastructure, education and healthcare dey affected.

Di International Trade Union Confederation (ITUC), Trade Union Congress (TUC) of Ghana and oda civil society groups say make international lending agencies and global financial institutions, cancel all di debts in wetin dem call debt reparation.

Dem bin present petition to di president of Ghana through di finance minister Dr Cassiel Ato-Forson.

Di protesters want make President John Mahama use im position as Africa Union champion for reparations to send di message to di donors and intentional agencies say make dem simply cancel di debts of Africa sake of say di continent dey "suffocate under unsustainable debts".

Dr Ato-Forson bin gree wit di groups say govments gatz dey transparent wit loans and debts and publish evri oan agreement on quarterly basis and explain to di citizens how di govment dey use dis debt.

Ghana total public debt dey around $67m according to di world bank, wia im neighbour Nigeria get debt wey dey range around $49.95billion as of March 2025 according to data from di Debt Management Office (DMO).

Di groups believe say Africa get resources wey fit provide di needs of di citizens for education, healthcare and jobs.

For dis demonstration, dem wan send clear message say Africa no go continue to accept "dis system of modern neo-colonial exploitation".

Protesters bin dey carry placards and banners wit messages like "Cancel Africa's Debt Now!", "Debt Cancellation na Reparation!", "People-Centred AfCFTA!", and "Stop the Bleeding! "among odas.

Di campaigners say dem bin write to lenders and donors through dia agents and embassies to join di protest for global financial institutions to listen to dia demand for justice.

Inside one statement, dem tok say "civil society groups, trade unions for di continent and oda movements go deliver petition to policymakers to demand debt cancellation, trade justice and reforms for di global financial system".

Ogbonge journalist and activist, Kwesi Pratt Jnr wey bin dey always tok about reparation dey quoted by state newspaper Daily Graphic say "no amount of moni fit compensate for di crimes wey di capitalist states bin commit against Africa".

"Wetin we want, na di complete reset of di world and di institutions to ensure equality of all pipo and to build new world wia all forms of poverty and exploitation dey banished forever," e tok.