Sorrow, tears and pain as Akeredolu make im final journey home

Akeredolu burial

Di former Govnor of Ondo state Rotimi Akeredolu, SAN, CON, dey make im final journey to di world beyond as family and friends gada to attend im funeral service on Friday.

Di final funeral service take place for di late govnor hometown for Owo wia dignitaries gada for St. Andrews Cathedral.

Di mood for di church na wetin we fit describe as sober wia pipo reflect and pour emotions from di heart.

Wen di deadi bodi of late Akeredolu bin enta di church, na everibodi stand-up as dem day carry am go di front of di altar.

Plenti govnors dey in attendance to witness how dia former counterpart dey go im final resting place.

Na Ondo state Govnor Lucky Aiyedatiwa bin lead oda govnors.

Odas wey dey present include Govnor Seyi Makinde of Oyo state; Govnor Godwin Obaseki of Edo state and Govnor Babajide Sanwo-Olu of Lagos state.

Di National Chairman of di APC, Abdullahi Ganduje and Nigeria Vice President Kashim Shettima also dey in attendance for di funeral service.

Former govnors wey attend di funeral service include Kayode Fayemi of Ekiti state, Senator Gbenga Daniel of Ogun state, Olusegun Mimiko of Ondo state amongst odas.

Odas include minister of Marine and Blue economy Adegboyega Oyetola.

Akeredolu na di former chairman of di southwest govnors forum wen im dey alive. Im be one of di strong voice wey dey behind di creation of di Amotekun security network wey dey combat insecurity for di region and e no dey surprising say dem put di Amotekun full uniform ontop im casket.

Sorrow, tears and pain as Akeredolu make im final journey home

Late Akeredolu nastrong man for im hometown
Wetin we call dis foto, Late Akeredolu wife, Betty pay respect to her husband
Di casket wey carry bodi of late Akeredolu

On Wednesday wey dem carry bodi of late Akeredolu enta Owo, na wit drums, shouts and tears dem use receive di bodi.

Dem conduct one of di traditional procession ‘Ajabue’ for am and major streets for Owo dey locked down sake of plenti pipo wey wan see di bodi of di late Akeredolu as dem dey carry am.

Same Wednesday, dem hold court session for di late govnor before dem come do di lying-in-state and commendation service for di Akure township stadium.

‘Aketi’ as many dey call am, na very courageous man, according to many.

During di lying-in-state, plenti dignitaries bin dey in attendance and di pipo for di state also come out in numbers to come see di govnor for di last time before dem go bury am.

Late Akeredolu na im create di Amotekun network

Wia dis foto come from, RotimiAkeredolu/BBC

More fotos from di burial

Akeredolu burial
Akeredolu burial
Akeredolu burial
Akeredolu burial
Akeredolu burial
Pipo for church during Akeredolu burial ceremony
Wetin we call dis foto, Late Akeredolu go dey laid to rest for Owo on Friday 23 February 2024
Wife of late Akeredolu with im son for church during di burial service
Wetin we call dis foto, Wife of late Akeredolu with im son for church during di burial service
Douye Diri, Seyi Makinde, Babajide Sanwo-Olu and Godwin Obaseki for di funeral service
Wetin we call dis foto, Douye Diri, Seyi Makinde, Babajide Sanwo-Olu and Godwin Obaseki for di funeral service
From left to right Ondo state Govnor Lucky Aiyedatiwa and Nigeria Vice President Kashim Shettima
Wetin we call dis foto, From left to right Ondo state Govnor Lucky Aiyedatiwa and Nigeria Vice President Kashim Shettima
Di Chairman of APC, Abdullahi Ganduje wit former Govnor of Ekiti state Kayode Fayemi and former Govnor of Ondo state
Wetin we call dis foto, Di Chairman of APC, Abdullahi Ganduje wit former Govnor of Ekiti state Kayode Fayemi and former Govnor of Ondo state
Ibikunle Amosun, Senator Gbenga Daniel and Adegboyega Oyetola dey in attendance
Wetin we call dis foto, Ibikunle Amosun, Senator Gbenga Daniel and Adegboyega Oyetola