How Akure, Owo stand still in last respect for late Govnor Rotimi Akeredolu

Collage foto of pallbearers dey carry Akeredolu casket and foto of am wen e dey alive

Wia dis foto come from, BBC/RotimiAkeredolu

Wetin we call dis foto, Late govnor Akeredolu dey behind di creation of Amotekun security network

Wen di bodi of di late govnor of Ondo state Rotimi Akeredolu, SAN, CON bin reach Akure, di state capital on Wednesday, heavy crowd gada wit tears for some pipo eyes.

Like di entrance of a general commander, dem carry di bodi with all form of respect and regards of di highest order as di pipo of Ondo state pay dia last respect to dia former govnor.

On Wednesday, dem hold court session for di late govnor before dem come do di lying-in-state and commendation service for di Akure township stadium.

Popularly called ‘Aketi’ by many, di late Ondo state govnor na very courageous man, according to pipo.

During di lying-in-state, plenti dignitaries bin dey in attendance and di pipo for di state also come out in numbers to come see di govnor for di last time before dem go bury am.

Many say, even for death, di late Akeredolu go remain an inspirational leader wit im influence.

Casket wey carry late Ondo state govnor Rotimi Akeredolu

Govnor Lucky Aiyedatiwa for im speech for di lying-in-state service on Wednesday tok say im predecessor na man of character and true service.

Aiyedatiwa say di late govnor go sleep and neva come back again so di celebration of life wey dem dey give am na life of a patriot wey live life.

“Na true about our late statesman Oluwarotimi Akeredolu. E get how Aketi life tell tori of how sacrifice and heroism fit help history. Aketi bin come to serve and im leave great marks”

“I remember how dis great man (Akeredolu) wey dey lie still here before us now bin take risk in service of a greater goal for im pipo at di heat of di avoidable farmers -herders/kidnapping and oda security challenges for our kontri,” Aiyedatiwa tok.

Late Akeredolu bodi enta im hometown Owo

Late Akeredolu na indigene of Owo

Wia dis foto come from, Richard Olabode

Wetin we call dis foto, Late Akeredolu enta im hometown Owo

For Owo, di hometown of late Akeredolu, na wit drums, shouts and tears dem use receive di bodi.

Dem conduct one of di traditional procession ‘Ajabue’ for am and major streets for Owo dey locked down sake of plenti pipo wey wan see di bodi of di late Akeredolu as dem dey carry am.

Na wetin dem fit describe as sober reflection and emotions from di heart n aim pipo show dat evening wey dem carry di bodi enta town.

Late Akeredolu bodi enta Owo for evening

Wia dis foto come from, Richard Olabode

Wetin we call dis foto, Di pipo of Owo come out to receive di bodi of di late Akeredolu

Di popular Emure junction for Owo dey filled wit crowd as dem receive di bodi of dia late govnor wit honour and respect.

Across di streets of Owo, na di chants and songs of ‘Aketi’ dem dey shout.

Di convoy bin drive through di streets of di town, and some students hold flags to wave as sign of respect to di late govnor.

Ajabue traditional procession for late Akeredolu

Wia dis foto come from, Richard Olabode

Wetin we call dis foto, Dem do Ajabue traditional procession for late Akeredolu

Di bodi of late Ondo state Govnor Rotimi Akeredolu bin touch down Akure, di Ondo state capital on Wednesday as part of di burial ceremonies dem don schedule for am.

Na 23 February, 2024 dem go bury di former govnor, Rotimi Akeredolu SAN.

Akeredolu bin die afta im battle wit cancer for Germany and dem bring im remains come back Nigeria on 5 January, 2024.

Di ceremonies to take am to im last resting place bin start on Thursday, 15 February.

Di final commendation service take place for Ibadan, Oyo state capital as dignitaries pay dia last respect on Tuesday.

For di All Saints Church Jericho Ibadan, crowd full as dem pray for di bodi of di late govnor.

Some pipo wey attend di service include Akeredolu wife, Betty Anyanwu Akeredolu, Justice Bolaji Olajuwon, Oluwarotimi Odunayo Akeredolu Jnr Babajide Akeredolu, Lady Ifeoma Atuegwu, Dr Teniola Akeredolu-Micheals and Pastor Kola Akeredolu.

Odas wey come include di deputy govnor of Ondo state, Dr. Olayide Adelami, former govnor of Ekiti state, Kayode Fayemi, former deputy govnor of Osun state, Sen. Iyiola Omisore, speaker House of Assembly Ondo state, Olamide Oladiji, APC Chairman, Ondo state, Ade Adetimehin and top goment functionaries.

Di atmosphere dey very sober wen di bodi of late Akeredolu bin enta di church.

Timeline: How Akeredolu burial go happun

Thursday 15 February, 2024:

Winning Soul Crusade for MKO Abiola Democracy Park, Akure

Friday 16 February:

Jumat Service for Akure Central Mosque

Saturday, 17 February

Loyola Day of Tributes for Loyola College Hall,

Sunday, 18 February:

OAU Night of Tributes

Monday, 19 February:

Special Court Session

Tuesday, 20 February:

Commendation Service

Private Viewing (Strictly By Invitation)

Wednesday, 21 February:

Ajabue (Traditional Rites)

Special Court Session

Lying in State and Commendation Service

Evening of Tributes

Thursday, 22 February:

Service of Songs

Wake-Keep

Candlelight Procession & World Gyration

Friday, 23 February:

Funeral Service

Interment go follow immediately afta di burial service for di burial site, Owo. (Strictly for immediate family)

Saturday, 24 February:

Akeredolu Memorial Friendly football match

Sunday, 25 February:

Thanksgiving Service

Ondo State govnor Lucky Aiyedatiwa, bin delcare February, Thursday 22 and Friday 23, as public holidays for di state.

Aiyedatiwa say na to honour dia late govnor.

More fotos from di ceremony

Casket wey carry late Ondo state govnor Rotimi Akere
Guards stand to honour di late Ondo state govnor Rotimi Akeredolu
Guards carry di casket of Aketi
Casket of di late Ondo state govnor, Rotimi Akeredolu