You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
PDP set to pick Atiku Abubakar running mate for 2023
Peoples Democratic Party (PDP) don set up committee to screen di party vice presidential candidate for 2023 election.
PDP wey be Nigeria main opposition party bin nominate former Vice President Atiku Abubakar as dia presidential candidate, two weeks ago.
Atiku win di party presidential primary election wit 371 delegate votes beating 12 oda aspirants on 28 May, 2022.
Now wey Nigeria main opposition party, PDP don give Certificate of Return to dia Presidential na to shop for di VP ticket remain.
PDP leaders bin meet on Tuesday 14 June, for dia national secretariat inside Abuja to decide on di mata.
Nigeria general elections go happun for February 2023 according to di timetable wey di kontri election body INEC bin release.
Now PDP dey required to fill a name for Vice presidential candidate wey go be running mate to Atiku Abubakar for Inec list of contestants.
BBC Pidgin find out say at least three southern govnors name dey di list of those dem dey consider, following Tuesday meeting.
Debo Ologunagba, di party PRO, say dem set up di committee pursuant to Part VI, Paragraph 14 of di Electoral Guidelines of di Party.
Di National Working Committee (NWC) approve di nomination of di Party members to serve on di Vice Presidential Candidate Screening Committee, Ologunagba tok.
Dem go do di screening/verifying of di nominated Vice Presidential Candidate of diParty for di 2023 general elections.
Meanwhile di National Advisory Committee meet yesterday for di party secretariat to select di pesin wey go be di party vice presidential candidate.
Di advisory committee dey chaired by di Deputy National Chairman, North, Ambassador Umaru Damagun give dia recommendation and afta dat di screening committee go do dia own job from Wednesday.
Some party leaders wey dey di meeting na Governors Samuel Ortom (Benue), Aminu Tambuwal (Sokoto), and Bala Mohammed (Bauchi).
Former governors Babangida Aliyu (Niger), Sule Lamido (Jigawa), Liyel Imoke (Cross Rivers) Olusegun Mimiko (Ondo) and minority leader of di House of Representatives, Ndudi Elumelu.
Di screening exercise go hold for di party National Secretariat for Abuja.
Di chairmo of di committee na Chief Tom Ikimi, wit oda members as Capt. Idris Wada (rtd), Chief Osita Chidoka, Rt. Hon. Binta Bello, Rt. Hon. Austin Opara, Prof. Aisha Madawaki and H.E. Fidelis Tapgun.
Wetin PDP constitution tok about Vice Presidential Candidate selection process
For PDP pipo wey get power to choose dia VP candidate na di National Executive Committee, through dia National Working Committee.
Dat na wetin di party constitution tok.
Na dem go provide di process of clearance of di waiver wey go start from di ward level.
But before dem reach dat level di pesin suppose meet some of dia party requirement wey be:
Di pesin go don be party member for at least two years.
However di party Executive Committee fit allow di pesin alias give am waiver if e no meet dis requirement.
How party go select vice presidential candidate
Na many tins party dey consider before dem pick pesin wey go be vice presidential candidate of di party. No be one pesin decision.
Usually consultations dey hold among major stakeholders of di party wey go reason togeda to decide who dem want.
“Di party, governors, National assembly caucus and di candidate go sidon to chose who dem want,” Alaiya Benneth, wey be poitical analyst tok.
E say “Di party go bring some names wey di presidential candidate go chose from.
"Dem go later check am well to see if di persin wey di candidate prefer go fit help di party win election.
“Dem go consider many tins like zone, region, interest, contribution and oda tins before dem reach final decision.”
Possible names wey fit be Atiku running mate
According to di Independent National Electoral Commission (Inec) candidates need to submit di name of dia presidential and vice presidential candidate.
Di presidential candidate of di PDP na from Northern Nigeria. Oga Atiku na from Adamawa wey dey North eastern zone.
Belief be say im vice go come from Southern Nigeria. E never clear which part of South di party go consider.
Sake of dia contribution to di party di govnors of PDP feel say one of dem deserve to be vice president.
But oda pipo expect say di party fit look beyond di govnors to nominate pesin wey fit help di party win di 2023 presidential election.
Some of di considerations na;
Ifeanyi Okowa
Oga Okowa na di govnor of Delta state for South south Nigeria.
Im don serve two term as govnor. Before den e serve as Senator retrogreening Delta North for National Assembly for 2011.
Di 62 year-old medical doctor wey turn to politician na from di igbo-speaking part of Delta state, Ika North-East.
E play ogbonge role for di emergence of Atiku Abubakar for di national convention of di PDP.
Udom Emmanuel
Udom Emmanuel na di current govnor of Akwa Ibom state for South south Nigeria.
Di govnor na one of di presidential aspirants for di PDP primary.
Im become govnor for 2015 and e don serve two terms.
Dem born di trained accountant for 1966.
Im na two term govnor wey enta office for 2015.
Before e join politics, Udom na Accountant wey don work for different banks for Nigeria.
Na former govnor Godwill Akpabio carry am enta politics wen e appoint am Secretary to di state goment for 2013.
Govnor Emmanuel say time don reach for men of proven integrity, character and experience to lead Nigeria.
Anyim Pius Anyim
Anyim come from Ishiagu for Ebonyi state, southeast Nigeria. E also contest as presidential of di PDP.
Im na former Secretary to di goment of di federation under president Goodluck Jonathan.
Im become Senator for 1999 and by 2000 e become Senate President. E serve for di position till 2003.
Anyim Pius Anyim dey 61 years and e say time don reach for southeast of Nigeria to produce di next president of di kontri for 2023.
E say im get wetin PDP need to return to power adding say im focus na to take Nigeria back to greatness.
Emeka Ihedioha
Ihedioha na former Imo state govnor wey no last for office before Nigeria Supreme Court remove from office for 2020.
Before den im na for Deputy speaker of House of Representatives. Im na strong support of di PDP presidential candidate Atiku.
Di 57 year old politician dey considered as one of di favourites sake of say e come from Southeast region and age still dey on im side.
Nyesom Wike
Nyesom Wike na ogbonge politician and im na current govnor of Rivers State for south-south Nigeria.
E come second behind Atiku for di PDP primary.
Di 59-year-old na lawyer wey dem call to Bar for 1997 and by 1999 e become local goment chairman of Obio-Akpor.
For 2007, Nyesom Wike get appointment as Chief of staff to former govnor Rotimi Amaechi.
By 2011 former Nigeria president Goodluck Jonathan appoint am minister of state for Education.
Na 2015 e become govnor of Rivers state and dey serve im second term.
Nyesom Wike say im administration as president go solve di leadership problem for Nigeria and sustain economic growth.