40-year-old Telegram boss wan leave im wealth to ova 100 children wey e born

    • Author, Peter Hoskins
    • Role, Business reporter, BBC News
  • Read am in 3 mins

Di founder of instant messaging app Telegram, Pavel Durov, tok say di more dan 100 children e born go share im estimated $13.9bn (£10.3bn) fortune.

"All of dem na my children and dem go all get di same rights! I no wan make dem begin fight each oda afta my death," Oga Durov tell French political magazine Le Point.

Oga Durov tok say im be di "official father" of six children wit three different partners, but im get more dan 100 oda children afta e donate sperm to one fertility clinic.

E also repeat am again say im no get hand for di serious criminal charges e dey face for France.

Di self-exiled Russian technology tycoon also tell di magazine say im children no go get access to dia inheritance for 30 years.

"I want make dem live like normal pipo, make dem build demsefs up alone, learn to trust demsefs, to fit create, make dem no dey dependent on a bank account," e tok.

Di 40-year-old tok say im don write will already becos im job "involve risks – defending freedoms go earn you many enemies, including within powerful states".

Im app, Telegram, dey known for im focus on privacy and encrypted messaging, e get more dan one billion monthly active users.

Oga Durov also address di criminal charges e dey face for France, wia dem arrest am last year afta dem accuse am of failing to properly moderate di app to reduce criminality.

E deny di accuse say im no gree cooperate wit law enforcement ova drug trafficking, child sexual abuse content and fraud.

Bifor now, Telegram bin deny say dem get insufficient moderation.

For di Le Point interview e describe di charges as "totally absurd".

"Just becos criminals use our messaging service among many odas no make dose wey dey run am criminals," e add.

Who be Pavel Durov?

Pavel Durov na multi-billionaire wey originally come from Russia.

E found di popular Russian social media company VKontakte.

For 2014, oga Durov comot from Russia afta e refuse to comply wit goment demands to shut down opposition communities on di platform.

One year bifor dat time, e bin found Telegram and now dey run di firm from Dubai for, United Arab Emirates (UAE), wia e dey live now.

E hold citizenship of di UAE and France, but Russia don tok say dem still regard am as dia citizen.

Afta e chop arrest, Telegram say oga Durov bin travel for Europe frequently.

For one interview wit di conservative US media personality Tucker Carlson for April, oga Durov say e go refuse certain requests from authorities to remove content from im platform.

E say: "Wia we tink say e go dey cross di line - e no go align wit our values of freedom of speech and protecting pipo private correspondence - we go ignore."