Court accept Ahmed Gulak death certificate as evidence against Kanu

Court accept Ahmed Gulak death certificate as evidence against Kanu
Read am in 4 mins

Di Federal High Court Abuja court for Abuja, Nigeria capital don adjourn di trial of

Indigenous People of Biafra [Ipob] group leader, Nnamdi Kanu to 21 May, 2025 to kontinu im defence.

Di trial of Nnamdi Kanu bin kontinu on Wednesday for court wia di prosecution present dia second witness, Mr BBB.

During di proceedings , court admit di medical report and death certificate of former presidential aide, Ahmed Gulak.

Di court admit dis documents as evidence for di ongoing trial of Nnamdi Kanu, wey dey face charges related to terrorism.

Justice James Omotoso, wey preside ova di proceedings, allow di prosecution witness wey dem identify as Mr BBB to tender di documents.

Im tender di documents wit no objection from di defence team wey Kanu Agabi (SAN), Chukwuma-Machukwu Ume (SAN) and Aloy Ejimakor dey lead.

Di prosecution, wey Adegboyega Awomolo (SAN) dey lead present di documents, wey include police report from Owerri, Imo State, south-eastern Nigeria, wey link Gulak death to gunmen wey dem suspect to be ipob members.

Team of Counsel to Nnamdi Kanu for di Federal High Court Abuja
Wetin we call dis foto, Team of Counsel to Nnamdi Kanu for di Federal High Court Abuja

How di proceedings waka

During di cross-examination, defence counsel Kanu Agabi challenge di credibility and completeness of di video statement wey dem bin obtain from Kanu wen im bin dey DSS custody.

Im tok say only di defendant and im team show for di video recording.

Di witness respond say, "Na di procedure be dat," im confam say na di full recording be dat.

Agabi raise di issue of how Kanu don overstay for detention and how im dey allegedly live a lonely life for detention.

Di witness, still tok say im be ordinary investigator and im no dey responsible for di custody of Kanu or im welfare.

Im tok say: "Solitary confinement no be di practice of di DSS. No be me be im handler."

Di defence still ask if di prolonged detention of Nnamdi Kanu dey legal, as im claim say na cruel and inhuman treatment in dey pass through, but di witness insist say im dey unaware of Kanu psychological state and no be part of im investigative duty.

Di defence counsel kontinu di witness question, di witness say im bin no dey among di pipo wey draft di charges and im no go fit confam di dates of different different charge amendments wey dem do against di defendant.

Oga Agabi say di charges dey speculative, and di witness still tell dem about im limited role as ordinary investigator.

Dem tell di court say despite plenti amendments wey dem bin don do for di charge sheet ova several years, di investigating officer bin no confront Kanu wit im accusers.

Di witness admit say dem bin only present a letter from di Attorney-General of di Federation (AGF) but dem no facilitate any face-to-face encounter.

Tensions rose bin rise wen Agabi argue say di AGF bin direct an investigation long afta dem file di charges.

Di witness say im bin no dey aware of wen dem bin file di charges. Im insist say im bin act only on di directive wey dem bin minute to am.

On requests for critical documents, Agabi inform di court say di defence bin apply for certain police records but dem neva receive dem yet.

Di prosecution counsel Awomolo oppose di adjournment, as im cite di court order for accelerated hearing, Justice Omotoso grant dem short adjournment.

"Di mata get international and domestic interest," di judge tok, as e warn against unnecessary delays.

"I dey inclined to grant di adjournment today to make sure say we hear di defence properly. Abeg use di opportunity well; we dey hia for justice."