You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Jeff Bezos and Lauren Sanchez Wedding: Kim Kardashian, Bill Gates, and oda celebrities wey dey Venice
Ogbonge celebrities and billionaires don dey land for di Island city of Venice for Italy to attend wetin many pipo dey call 'di wedding of di century' between Jeff Bezos and Lauren Sanchez.
Di high profile guests wey include Kim Kardashian, Bill Gates, Oprah Winfrey, and Usher don already tanda gidigba for di city for dis extravagant wedding of di oga of Amazon and im sweetheart wey be former TV host for Fox Sports.
Oda pipo wey don also arrive Venice na Kylie Jenner, Orlando Bloom, former NFL superstar Tom Brady, and Ivanka Trump and her husband Jared Kushner, as tori pipo capture dem wen dem dey enter water taxis.
President Donald Trump bin don post on im Instagram handle say "(We dey) Ready to celebrate di love tori of our friends".
Dis wedding wey dey expected to happen dis weekend go cost more dan 40 million pounds.
More billionaires and A-list celebrities still dey expected to enta Venice for dis wedding, even though some of di locals bin don protest say dem no want make di wedding happen for di center of di city.
Bezos and Sanchez don dey date openly since 2019 but dem become engaged for 2023.
Dis na wetin we know about di wedding wey don dey make headlines.
Who be di bride?
Dem born di 55-year old Lauren Sanchez for Mexico, and she bin study for di University of New Mexico and also di University of Southern Californiana, wia she learn acting and speech, and communication respectively.
She make her name in broadcasting as anchor wit Fox Sports and she bin also win di prestigious Emmy Awards.
Also, Sanchez bin host big reality TV shows like di season one of "So You Think You Can Dance" in 2005, bifor she move on to oda tins.
She be di founder of Black Ops Aviation - a company wey dey into aerial film production.
Currently, she be di Vice Chair of di Bezos Earth Fund, one non-profit organisation wey Jeff Bezos set up to fight climate change and protect nature.
Sánchez get three children already, one son wit Tony Gonzalez who bin dey play for National Football League for di US, plus one son and one daughter wit her ex-husband, one Hollywood oga, Patrick Whitesell.
Wen and wia be di wedding?
Di date of di wedding never dey clear but reports say e go hapun later sometime dis week to end wit ogbonge event on Saturday.
As for di venue, wetin we know be say di wedding event go happen for di tourist town of Venice in northeast Italy.
Dem no officially reveal di exact venue for di wedding, but tori be say di grand finale bin suppose happen for di Scuola Grande della Misericordia, one old church wey dem build in 1310, but wey dem renovate recently and dey use am as big event centre.
However, sake of protests by di local residents, officials confirm to BBC say di guests go now gather for di Arsenale, anoda ogbonge venue but e dey a bit far from di city centre.
Di Arsenale dey for highly fortified area, surrounded by imposing walls, and dem bin use am as a naval ship yard for di Republic of Venice for di 15th-century.
Who and who dey expected to attend?
Di event na strictly for some 200 to 250 pipo wey di couple invite, according to a statement by di Venice city management.
Di A-List star studded guest lists include Kim Kardashian, Oprah Winfrey, Bill Gates, Usher, plus some of di Trumps.
Why locals protest against di wedding?
Di issue of over-tourism na serious one for Venice, as e be for across southern Europe.
Protesters claim say dem wey be locals dey priced out of dia beautiful city by too many visitors, and say climate change don put di city wey dey popular as "Di city-on-water' at major risk of flooding.
On Monday, activists wey call diasef 'Everyone Hates Elon' bin unveil one giant image of Bezos for Piazza San Marco - a popular square for Venice - protesting against di super-rich wit di slogan: "If you fit rent Venice for your wedding den you fit pay more tax."
"Our protest no be about di wedding itsef - na about wetin e dey represent," one protester Simona Abbate, tell BBC.
"Dis no be just celebration of two people wey wan marry, na display of a lifestyle wey simply no dey sustainable. Di richest dey live in excess, while odas dey endure di consequences of a climate emergency wey dem no create."
Afta di organisers announce say dem don change di venue, one protester wey im name na Tommaso Cacciari, from a group wey call diasef 'No Space for Bezos', tell BBC say e dey very proud of dia achievement.
"We be nobodies, we no get money, nothing! We be just citizens wey start to organise, and we manage to move one of di most powerful pipo in di world - all di billionaires - out of di city," e tok.
However, one councillor for di city, Simone Venturini, dey vex for di protesters and e accuse dem of behaving as if na dem get Venice.
"Nobody go decide who go marry for here," Venturini tok.
"Dis event involve just 200 carefully selected guests, e go bring major economic benefits to di city, and all di events go dey hosted for privately-owned venues." e tok.