Russia suspend participation for Ukraine grain exports deal

General cargo ship "Kubrosli Y." for di sea port wey dey Odesa after restarting grain export

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, General cargo ship "Kubrosli Y." for di sea port wey dey Odesa after restarting grain export

Russia don suspend dia participation for one deal wey U.N. strike to export agricultural produce from Ukrainian ports afta attacks on im ships for Crimea, Russia defence ministry tok on Saturday.

Moscow decision na big blow to one three-month agreement wey suppose scarcity of grain supplies for world.

Russia say Ukraine forces, use drones attack ships from di Black Sea Fleet for Sevastopol, di biggest city for di Russia-annexed Crimea, early momo on Saturday.

"Considering... di terrorist act wey Kyiv regime do wit di participation of British experts against di ships of di Black Sea Fleet and civilian ships wey get hand im=n making sure say di security dey for di 'grain corridor', Russia side don suspend im participation for di implementation of agreements on di export of agricultural products from Ukraine ports," di ministry tok for statement.

Di ministry bin tok earlier say dem bin really defend di drone attacks Saturday, wit minor damage to one Russia minesweeper.

Ukraine president chief of staff, Andriy Yermak, accuse Russia of "blackmail" and "invented terror attacks" on im own territory on Saturday afta di explosions for Crimea peninsula on Saturday.

Im comments na obvious response to Russia accusations say Ukraine dey behind di blasts.

For separate tok, Russia Agriculture Minister Dmitry Patrushev bin earlier tok on Saturday say Russia dey ready to supply up to 500,000 tonnes of grain to poor countries in di next four months for free, wit assistance from Turkey, and supplies of Ukraine grains.

"Taking into account dis year harvest, Russian Federation dey fully prepared to replace Ukraine grain and deliver supplies cheap price to all interested kontris," im tok.

Since Russia and Ukraine sign di U.N.- supported Black Sea Grain Initiative for Turkey on July 22, several million tonnes of corn, wheat, sunflower products, barley, rapeseed and soya don export from Ukraine.

United Nations aid chief Martin Griffiths bin only tok on Wednesday say im “get high hope” say dem go extend di deal pass middle of November.

Under di agreement, Ukraine bin dey able to restart im Black Sea grain and fertilizer exports, wey dem stop wen Russia bin invade dem on Feb. 24. Di Ukraine export deal bin initially suppose last for 120 days.

Machine dey harvest grains

Wia dis foto come from, Reuters

For separate statement, Russia foreign ministry say as par di attacks on Russian ships "di Russia side no go fit guarantee di safety of civilian dry cargo ships wey dey participate in di "Black Sea Initiative", and suspend di implementation from today for indefinite period.

"Russian representatives wey dey di Joint Coordination Center for Istanbul, wey dey control di transportation of Ukraine food, don already get relevant instructions" e add, referring to Turkey role for implementing di deal.

Late on Friday one tok tok pesin for U.N. Secretary-General Antonio Guterres bin beg di two kontris to renew di deal.

"We underline di urgent need of doing so to contribute to food security across the world, and to cushion the suffering that dis global cost-of-living crisis dey cause billions of pipo," U.N. tok tok pesin Stephane Dujarric say.

Dujarric say "goments, shipping companies, grain and fertilizer traders and farmers all over di world" dey look forward to understand di future of di deal.