Wetin dey happun between Elsa Majimbo and Naomi Campbell

Wia dis foto come from, Getty Images
Kenyan influencer, Elsa Majimbo recently drop and delete video on top wetin happun to di relationship between her and British supermodel Naomi Campbell.
For di video, she tok about how di relationship between her and Naomi Campbell take spoil ova di years.
She say na sometin wey her fans bin don dey ask for tay-tay becos, she bin dey call Naomi Campbell, her mentor.
And even afta she delete di video and some specific tweets in reference to di video, she tweet for X say, "I stand by my words... Di tweets dey deleted sake of say I dey find peace no be because of fear."
Elsa reveal for her video expose say, she and Naomi bin first meet for December 2020 wen Naomi bin visit Kenya for holiday and na from dia relationship start.
Di proof still dey for Naomi YouTube channel wia she bin follow di Tiktok star do interview on top di way she blow for social media.
Elsa mention say even though Naomi no be di pesin wey make her career, "she be di pesin wey give me credibility wen I dey enta dis space."
Elsa Majimbo relationship with Naomi Campbell
Elsa tok plenti tins for dis TikTok video wey bin go viral, like how dem meet, wen Naomi bin share her idea give Elsa and how tins take fall apart.
End of Di one wey oda users dey read well well
Elsa reveal say, "she be di first celebrity I ever meet so I bin dey super excited".
She go on to explain how Naomi bin carry her go holiday and during di trip bin give am idea say make she do documentary of how she dey comot from Kenya.
Sometime afta di trip Elsa say pesin tell am say Naomi bin dey go up and down dey tell pipo say na she make Elsa career.
Fast forward to March 2022, and Elsa bin comot wit her short documentary wey she self title.
Dat na wen kasala burst as Naomi Campbell bin allegedly tell am say she go sue sake of say Elsa use her idea do video without am.
Elsa tok say she apologise and try explain di mata.
For 2021, Elsa say, "I bin do documentary about my life, about bullying about colurism, about comedy. So, di feem bin dey comot for di Tribeca film festival and pesin bin ask Naomi weda she dey come. So she bin tink say I do di documentary wey she bin tell me about for di beach.
"I try explain say no be wetin di feem dey about. And den she tok say, 'I go sue you for di rights of dis feem and you know say I go win'."
But because say she no quick call back to tackle di first mata, Naomi bin tell Elsa say make she no follow am tok again.
Tins start to dey red for Elsa for 2023. She reveal say di mata make am start to dey drink.
Although, she bin reason say na Naomi bin dey behind wetin dey do her career, "I meet Edward Enninful for one party and e tok sometin wey make me tink say di kwanta wit Naomi na im cause some of di trials and tribulations I dey go through".
Elsa say di wahala for her life na im make her start to dey drink wella.
Afta dat party, she find way to settle wit Naomi, afta which she start to dey tell di model everytin wey dey happun for her life but she find out say dat one sef no really make sense. So she stop to dey do am.
Although Naomi Campbell neva publicly ansa to di state of di relationship, Elsa don give small glimpse wen she say, "we no be friends we no be enemies, we no be anytin, we just be strangers."
Who be Elsa Majimbo?

Wia dis foto come from, Getty Images
Elsa Majimbo na 22 year old content creator from Kenya wey blow during di Covid 19 pandemic.
Her comedy videos wey she post online bin involve her lying for bed just dey tok about how she like money and oda satirical tins wey if you take am seriously you go tink say she get pride.
She also be a 15 time Chess Champion.
For September 2020, she bin run one of her first major campaign wit Fenty sunglasses as she dey crack her usual jokes.
By December of dat year, GQ name Elsa Majimbo as di entertainer of di year.
Dat same month di award for online videos, Streamys award honour Elsa as di Best New Comedy Creator.
For February 2021, she bin collect nominated for di Nickelodeon Kids Choice Awards (KCA) as "Favourite African Social Media Star".
She follow act for di Nickelodeon TV Movie wey dem call The Great Nickmas Tree Sliming for 2022.













