Video show moment bridge collapse afta ship jam am

Wetin we call dis Video, Moment Baltimore bridge collapse afta e dey hit by ship
Video show moment bridge collapse afta ship jam am

About 20 pipo don fall for river afta one bridge for Baltimore, Maryland, collapse inside Patapsco River.

Di collapse happun wen one container ship bin hit am, rescue services tok.

Chief Kevin Cartwright, director of communications for di Baltimore City Fire Department, confam to BBC say di bridge dey struck by "one large vessel" wey cause am to collapse into di river.

E also tok say "as many as seven individuals and several vehicles" don fall inside di river.

Now, multi-agency rescue operation don tanda for di scene.

Plenti vehicles also fall into di river, Baltimore City Fire Department, tok as dem declare di incident as "mass casualty event"