Malawi election results: Vote count show say ex-president Peter Mutharika dey lead

    • Author, Nomsa Maseko
    • Role, BBC Africa
    • Reporting from, Lilongwe
  • Read am in 3 mins

Malawi former President Peter Mutharika don take comfortable lead for di kontri presidential race, as two-thirds of districts don report provisional results.

Di 85-year-old don receive around 66% of di valid votes wey dem don count so far, and im closest rival, di incumbent Lazarus Chakwera, wey be 70-year-old get around 24%.

Results wey dem don declare so far show say Oga Mutharika win for areas wey dey known to be Chakwera strongholds, plus di capital, Lilongwe, and Nkhotakota.

But Chakwera camp neva give up, dem say once dem declare di results from oda areas, im vote go increase and e fit force a run-off.

One candidate go need more dan 50% of di vote bifor dem fit declare am as winner, as Malawians dey eagerly wait for di final result from last Tuesday election.

Malawi Electoral Commission get until di end of Wednesday, 24 September to announce am.

At least two of di 12 districts wey dem neva declare dia results get large number of registered voters, and Chakwera camp believe say im go do well for dia. E include rural areas around Lilongwe and Dedza.

Di electoral commission don hold di results of two districts wia Mutharika dey expected to do well, as dem dey check weda di results dey accurate.

Di commission say dem dey committed to transparency, accuracy and credibility.

Dem add say dem dey carefully check every tally sheet, afta di constitutional court cancel Mutharika victory for 2019 sake of irregularities.

Chakwera bin win di re-run by a wide margin, but during im presidency, Malawi economic crisis don fall seriously, wit high inflation, food and fuel shortages and constant power cuts.

On Friday, Chakwera party tok say dem discover "irregularities" and "serious anomalies", and don ask di electoral commission to conduct "physical audit" of results. Di party no tok wetin di irregularities be.

Police say dem don arrest eight data entry clerks on top accuse say dem bin dey try to manipulate results.