NDC na better opposition for Peter Obi, e go fit win wit dem for 2027?

Read am in 4 mins

Presidential candidate under di Labour Party for 2023 election, Peter Obi don run go new party Nigeria Democratic Congress (NDC), but e go fit use am face oda big parties for di 2027 election?

Dis new party make am about di fifth political party wey Peter Obi don join so far for Nigeria.

On 3 may 2026, di former govnor of Anambra State Peter Obi and di ex-govnor of Kano State Rabiu Kwankwaso announce say dem join di NDC.

Dis dey come afta di former presidential candidate for di 2023 general elections bin confam say e dey comot for di African Democratic Congress (ADC).

Obi give di informate for im X page on Sunday 3 May, wia e tok say im decision na sake of di endless court cases, internal battles, suspicion, and division for di party.

NDC na party wey say dem wan respond to 'demand for disciplined governance, long term national planning, and institutional accountability', but how dem go fit pull dat kain strength for Nigeria?

Wit just few days to di end of timeline wey di Nigeria electoral body, Independent National Electoral Commission (Inec) give for di deadline for parties to do dia primaries and submit names of candidate, Peter Obi bin neva get stable party to contest.

Im new party, NDC na new party wey just dey gada supporters across di kontri and im announcement to join don also increase di popularity of di party.

Howeva, di big kwesion remain if Peter Obi go fit face di incumbent All Progressives Congress (APC), Peoples Democratic Party (PDP) and oda big political parties for di 2027 election wit NDC.

Wetin to know about Nigeria Democratic Congress (NDC)

Di Nigeria Democratic Congress (NDC) na one of di two political parties wey Inec recently register.

E mean say NDC na party wey dey officially registered for 2026.

For February 2026, di electoral body present certificate of registration to di NDC.

According to information for NDC website, dem say dem get 774 chapters across Nigeria wit ova one million registered members.

Di National Chairman of NDC na Senator Moses Cleopas, di party also get oda national working committee members.

Di founder and national leader of NDC na Senator Henry Seriake Dickson, former govnor of Bayelsa State and Senator representing Bayelsa West Senatorial District.

Dickson na former PDP member but e comot di party to form im own political party.

According to Seriake Dickson, na for 2017 dem bin first start di process to register NDC as political party for Nigeria but di process no go through under di former Inec chairman, Mahmood Yakubu.

Later for 2025, Dickson begin di registration process again wen Inec lift di embargo to register new parties. Na about 171 party applications show up dat time.

NDC later receive letter from Inec about di application say dia logo wey be two-finger sign, dey similar to dat of di APC broom.

Later on, NDC drag Inec go court ova di logo wahala and di court later say make Inec register NDC as political party.

Which chance Peter Obi get with NDC?

During di 2023 election, Peter Obi under Labour get 6,101,533 votes for third position while Kwakwanso get 1,496,687 votes for fourth position- losing to APC Bola Tinubu.

Many go expect say as Atiku Abubakar wey come second for di last presidential election wit Obi and Kwakwanso gada run go di ADC, dem go fit combine strengths ahead of 2027.

But di court cases wey dey hang ontop ADC head force Obi and Kwakwanso to run comot again go NDC- and e neva sure if na dem go even get di presidential ticket.

Howeva, di political journey of Peter Obi dey make pipo ask how im supporters go continue to dey wit am as e dey go from one party to di oda.

How many parties Peter Obi don join?

Peter Obi enta full-time politics wen e contest for di 2003 Anambra State gubernatorial election under The All Progressives Grand Alliance APGA.

E bin no first win, but court later throway di winner Chris Ngige and declare Peter Obi winner and im administration start for 2006.

Obi later join PDP, wia e become di Nigerian vice presidential candidate to Atiku for di 2019 election but dem lose to Muhammadu Buhari of APC.

For 2022, Obi run go Labour Party to contest as presidential candidate for di 2023 Nigerian presidential election. E lose di election to APC again.

By 2025, Peter Obi and some oda big politicians begin dey join bodi to form coalition to unseat di sitting Nigeria President Tinubu.

Peter Obi become member of African Democratic Congress (ADC) wit di likes of Kwakwanso, Atiku and oda politicians.

By May 2026, Obi don go NDC- a party wey be just less dan five months.

At di moment, e neva clear weda NDC go give Peter Obi presidential ticket for di 2027 election, or even Kwakwanso.

But as per say na dem be di only big names for di party wey dey find chance to contest for 2027 president, all eyes still dey ontop di NDC party.

For NDC, as per new party, dem neva get big politicians aside dia National leader and di two former presidential candidates wey just join.

Howeva, pipo wey don defect go NDC so far include;

  • Former Adamawa governorship candidate and ex-senator, Aishatu Dahiru Ahmed Binani, wey officially join di NDC,
  • Former Zamfara Senator, Kabir Marafa dump ADC for NDC. Marafa na former member of di National Assembly wey don join NDC,
  • Peter Obi, former Anambra govnor and former LP presidential candidate
  • Rabiu Kwakwanso, former Kano govnor and former NNPP presidential candidate