You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kamala Harris don get enough support to gbab Democratic nomination
- Author, Christal Hayes
- Role, BBC News, Los Angeles
- Read am in 3 mins
US Vice-President Kamala Harris don secure di support of a majority of Democratic delegates to become di nominee of di party to run for president.
One survey wey di Associated Press do on Monday evening show say Harris don receive di endorsement of more dan 1,976 delegates, di minimum number wey pesin need to win di nomination for di first round of voting.
E mean say she dey on course to be crowned di standard bearer and face Donald Trump of di Republican Party for di November presidential election.
Her nomination go become official wen party delegates hold a roll call vote ahead of di Democratic National Convention (DNC) wey go happUn for Chicago next month.
Delegates na pipo wey dey selected to represent dia electoral area. Dia pledges of support no dey binding until di vote but e no dey likely to change.
So far, nobody don publicly come forward to challenge Kamala Harris since President Joe Biden comot for di race on Sunday.
Biden bin come under pressure from senior members of im party afta im first debate against Trump wia e stumble ova im words repeatedly.
If di total hold between now and wen delegates go cast dia votes, wey go happen from 1-7 August, Harris go formally get di party nomination.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di survey by AP na indication of di support wey Democrats get for Ms Harris afta President Joe Biden drop out of di race on Sunday.
Since Biden make dat announcement, millions of dollars in donations don pour into her campaign and leading Democrats don line up to support her bid as di Democratic nominee.
For her campaign headquarters for Wilmington, Delaware, on Monday evening, Harris - wey bin start her career as a prosecutor for California - tok say "I know Donald Trump type".
She tok say di Biden-Harris campaign na always about two different versions of di future of America.
"One dey focus on di future, di oda dey focus on di past," she tok.
"Donald Trump wan take our country backwards... we believe in a brighter future wey go make room for all Americans."
She also point out evri thing wey Biden achieve as president, and tok say her time serving as im vice-president na "one of di greatest honours of my life".
Before Ms Harris climb di stage, Biden bin make im first comments since dropping out of di 2024 election through phone call as e dey isolate afta e catch Covid-19.
E thank im aides and tell dem to "embrace" Ms Harris because "she na di best".
"I know say yesterday news dey surprising and hard for you to hear, but na di right tin to do," Biden tell dem.
E vow say e go remain fully engaged for di campaign bicos democracy dey at stake.
Meanwhile Trump running mate, Senator JD Vance, attack both Kamala Harris and Joe Biden as e campaign for Virginia.
“History go remember Joe Biden as not just a quitter, wey e be, but as one of di worst presidents in di history of di United States of America,” e tok.
“But my friends, Kamala Harris dey a million times worse and evribodi know am. She sign up for evri single one of Joe Biden failures, and she bin lie about im mental capacity to serve as president.”