Lady inside viral video wey show how guys hold am down dey flog tok wetin happun

Five guys wey allegedly beat one lady inside viral foto

Wia dis foto come from, Kwara State Police Command

Di Kwara State Police Command don conclude investigation and charge to court one suspect Jimoh Abdulfatai and four of im friends on top accuse say dem mercilessly beat one young lady, for inside video wey go viral for social media recently.

On Tuesday, di video show as some guys hold one girl tight begin flog and tok to her anyhow on top accuse say she dey cheat on im boyfriend.

Di court don remand di suspects for prison pending hearing and actual trial of the mata. Judge adjourn di case to 1 July.

Suspect Abdulfatai Jimoh

Wia dis foto come from, Kwara State Police Command

Police Public Relations officer for Kwara Command, Ajayi Okasanmi for inside statement wey e give BBC Pidgin say di mata happun for Shao, Moro Local goment area of Kwara State.

E explain say di suspect Jimoh Abdulfatai plus four of im friends, Olamide Babatunde, Afeez Ayomide, Agboola Abdulsamad and Yakubu Mustapha hold di girl hands begin flog her on top accuse of infidelity.

Oga Okasanmi say di suspects confess to di crime and give reason why dem do wetin dem do.

“Di reason for dia senseless action na because of suspicion of infidelity on di part of di lady wey deny am. Even as she dey tell dem say she no dey cheat, di boyfriend forcefully collect di lady phone and give di phone to one of im friends to video di actions and later post am on social media."

“Your life wan spoil, wia you get money to buy fone, you wan dey unfortunate." Dem tok for di video as di girl dey beg dem.

Di victim narrate wetin happun

BBC Pidgin follow, di girl wey dey di viral video tok. She tok her own side of di tori.

She tok say she no be AbdulFatai girlfriend say dem just be friends contrary to tori wey dey fly up and down say dem dey date.

"I go my friend house as e say im wan see me, I know no say im and im friends get oda plans. Dem accuse me of doing shakara for Fatai and dey engage for hookups also dey cheat. I tell dem say I no dey am before dem begin beat me and use my fone to video di beating” She tok..

Di victim say na pipo wey see di video online go report to di police.

She also say she dey very sad wit di incident wey happun and her greatest concern na if she no go dey rusticated from school as she be student of di universities.

She also say wetin she want na justice.

Wetin di law tok about domestic violence?

Domestic abuse na di deliberate act and persistent abuse of anyone in a way wey fit cause pain, injury or suffering.

Na for May 25, 2015, former President Goodluck Jonathan sign di Violence against Persons (Prohibition) Act 2015 into law.

Di VAPP act dey seek to comot violence for pipo private and public lives plus provide punishment for offenders.

Section 19 (1) of di VAPP Act tok say na criminal offence for a spouse to physically attack his or her partner.

Different penalties na im dey for dis crime from three years imprisonment or N300,000 fine to one year imprisonment or 100,000 fine.