Why dis Labubu doll wey big like human being sell for more dan $150,000

    • Author, Adam Hancock
    • Role, Business reporter, BBC News
  • Read am in 3 mins

One human-sized Labubu doll sell dis week for a record 1.08m yuan ($150,324; £110,465), according to one Chinese auction house.

Di 131cm (4ft 4in) doll sell for Yongle International Auction for Beijing. Di auctioneer say e don become now di most expensive toy of im kind for di world.

Labubu dolls be one kain monster character wey one Hong Kong artist Kasing Lung, create years ago wey don dey popular in recent years after some celebrity endorsements.

Labubu dolls, wey Chinese toy company Pop Mart dye sell, dey usually cost around 50 yuan.

Dis week auction bin dey dedicated entirely to Labubu.

Forty eight items na im dem put on sale with around 200 people in attendance.

Di auction house say dem raised a total of 3.37m yuan.

Di dolls don cause one kain worldwide buying rush after e appear well-well for social media posts by Lisa from K-pop group Blackpink.

Di soft toys become viral TikTok trend after oda celebrities including Rihanna and Dua Lipa wear am.

Former England football captain David Beckham also post one photo on Instagram of one Labubu wey dey attached to im bag.

Earlier dis year, Pop Mart comot di dolls from all UK stores after reports say customers dey fight over dem.

Di Chinese retailer dey often sell di collectable toys inside mystery "blind boxes".

Dis items dey popular with customers wey dey only find out di design of di toy once dem open di package.

Di popularity of Labubu toys don contribute to di success of Pop Mart.

Di firm revenue be 13m yuan for 2024, more dan double di figure wey dem see di previous year.

Dem open new stores for five countries including Italy and Spain last year.