Nigeria vs South Africa rivalry don pass 'be kiaful'? - Wetin dey happun

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria High Commission for Pretoria, South Africa don cut warning for Nigerians wey dey South Africa ahead of di 2023 Afcon semi-final match.
Di High Commission advice di Nigeria community to shine dia eyes well-well and make dem carefully choose wia dem go watch di match wey go shele on Wednesday 7 February, 2024 for di Buoake Stadium.
For di statement, di Nigeria High Commission say na sake of some "potentially imflammatory online comments wey some section of South African citizens dey make against Nigerians wey dey live for di host kontri" make dem bring out dis advisory.
Dem add say some of di comments na threat against "Nigerians wey dey cook jollof rice, bifor di match and "to show pepper to Nigerians if di Bafana Bafana lose to di Super Eagles."
Make dem also avoid comments wey go provoke pipo and too much celebrations wey fit cause kasala if Nigeria win.
Meanwhile, di Department of International Relations and Cooperation (DIRCO) for South Africa describe di statement as “one unfortunate advisory wey High Commission of the Federal Republic of Nigeria for Pretoria issue”.
Di South African cooperation say di dey “regrettable” becos e create alarm and unnecessary tension between di citizens of South Africa and Nigerians wey dey live visit South Africa.
“Di South African national soccer team, Bafana Bafana, don play against dia Nigerian counterparts, di Super Eagles, on many occasions, and no history of soccer hooliganism among South Africans don happun bifor.”
End of Di one wey oda users dey read well well
DIRCO say dem dey confident say dia sports-loving nation no be threat to Nigerian citizens.”
Nigeria and South Africa na two kontris wey dey di African continent.
Dem be brodas sake of say dem from di same continent, but di rivalry between dem too much.
Positives of Nigeria South Africa relationship
Nigeria and South Africa dey drag di biggest economy for di continent. Sometimes Nigeria go top di economy while oda times South Africa go dey ontop.
Nigeria bin don support South Africa goment in di past, especially during di apartheid.
Over di years, dis two kontris don enjoy good bilateral relationships wit each oda, but dis relationship still get coma, especially wen kasala burst.
Dem dey drag superiority for almost evritin, especially for music, business, lifestyle and sports.
Nigeria and South Africa relationship get good sides and one of di tokin points na di support Nigeria give South Africa during apartheid.
According to one publication wey Nigeria Institute of International Affairs publish for July 2023, dem tok say:
"Nigeria under di leadership of General Olusegun Obasanjo, lead Nigeria and oda African kontris to boycott di Olympics afta di International Olympic Committee no gree sama New Zealand ban, sake of say dia rugby team tour South Africa against di resolution of di United Nations’ of a total sporting embargo against diracist Apartheid regime."
Tori also show say Nigeria bin donote money to South Africa to support dem too.
Dis gesture make di two kontris bond well well in di past but now e be like say di relationship dey get K-leg small small.
Wetin Nigeria and South Africa dey drag?
Till now e no dey clear wetin Nigeria and South Africa dey drag. But we go still tok about di bad side of dis relationship.
No be news say plenty Nigerians dey stay for South Africa and South Africans too dey live for Nigeria.
But for some reasons Nigerians no dey safe for South Africa, with the Xenophobix=c attacks wey dey come and go.
Nigerians for South Africa dey complain endlessly of killings and attacks wey dia South African brodas dey give dem.
Tori about how South Africans dey attack shops, houses and businesses wey belong to Nigerias dey plenti.
Anoda area wey dem dey drag superiority na for music wey be one of di tins di two kontris dey passionate about.
Di Amapiano versus Afrobeat music dey make dem bond and e dey also cause kasala.
Dis dey visible for di recent Grammy Awards wey South African musician Tyla beat all Nigeria big names like Burna Boy, Davido, Asake and Arya Star win, still dey cause arguement.
As e dey peppers Nigerians, e dey sweet South Africans. Since on Monday afta di Grammy Awards, di streets of social media neva rest.
Even as Nigerian ogbonge musician Davido congratulate Tyla dem still drag am ontop di matter.
Anoda area wey dis rivalry dey strong na for sports, especially football and di ongoing Africa Cup of Nations semi finals don begin raise di dust again.
Nigeria and South Africa football rivalry
On Wednesday, 7 February, 2024, di Super Eagles of Nigeria get scores to settle wit di Bafana Bafana of South Africa.
Di 2023 Afcon semi-final match go happun for di Bouake stadium by 6pm West African Time.
Di match na a repeat of di 2000 semi-final wey saw di Super Eagles beat di 1996 champions 2-0 for Lagos.
Many eyes dey ontop dis match for different reasons. For some Nigerians dis match na part of di revenge dem wan give South Africa for di Grammy Award wey Tyla win.
For some South Africans na anoda opportunity to settle old scores wit Nigeria especially as dem dey try close di Afcon gap wey Nigeria and South Africa get.
Nigeria don win three Africa Cup of Nations title for 1980, 1994 and 2013 while South Africa don win only one for 1996.
Nigeria don qualify for World Cup 6 times, dia first appearance na for 1994 while South Africa don go 3 times and dia first appearance na for 1998.
Head to Head
Nigeria and South Africa don meet each oda 14 times for different matches like Fifa World Cup, Afcon and International friendly matches.
Dia first meeting happun for 10 October, 1992 and Nigeria beat South Africa 4-0.
Nigeria beat South Africa 4-0 again on 31 January, 2004.
Di last time dem face each oda na for di Afcon 2019 edition for Egypt.
Both of dem qualify for di Rounfd of 16 from dia different groups. Dem later jam for di quarter-finals, but Super Eagles beat dem 2-1.
So far, Nigeria dey beat South Africa for head-to-head performance, out of di 14 times dem don meet Nigeria win 7, draw 5 and lose two.
Afta di Quater-finals matches wey tie Nigeria and South Africa togeda, Social media streets begin buzz.
Nigerians say dem go beat South Africa while South Africans say dem go show Nigeria pepper. Na few hours remain for dis mata to settle.













