Meta threaten to close Facebook for Nigeria sake of plenty fines by govment - report

Read am in 3 mins

Pipo wey dey for Nigeria fit lose access to Facebook and Instagram as Meta wey be di main company wey get dem tok say dem dey face heavy fines and some "unrealistic" wahala wey Nigerian authorities dey give, according to Africa report.

Last year, three Nigerian oversight agencies put fines for di US-based social media giant wey reach over $290 million (₦218 million) for breaking different laws and rules.

Meta no succeed for recent court case wey dem carry go federal high court for Abuja to fight di decision.

"Di applicant fit dey forced to shutdown Facebook and Instagram for Nigeria so dem go fit reduce di risk wey go come if dem no comply," na wetin di company tok for court papers.

Na Meta still get WhatsApp, but dem no tok anytin about di messaging app for dem statement.

Di High court don give di company till end of June to pay di fines.

BBC don ask Meta make dem tok wetin dem go do next but Meta neva reply.

Facebook na di most popular social media platform for Nigeria and millions of pipo dey use am evri day to tok and share news. E still be important tool for plenty small online businesses for di kontri.

For July last year, dem ask Meta make e pay three different fines:

  • Di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) put $220 million fine for wetin dem call anti-competitive behaviour.
  • Di advertising regulator still fine dem $37.5 million sake of adverts wey dem no approve.
  • And di Nigerian Data Protection Commission (NDPC) tok say Meta break data privacy law and fine dem $32.8 million.

FCCPC Oga, Adamu Abdullahi tok say di investigations wey dem do togeda wit di data commission from May 2021 to December 2023 show say Meta dey use "invasive practices against data subjects/consumers for Nigeria" but dem no tok exactly wetin happun.

For court, Meta tok say na di data commission be dia "primary concern", wey dem accuse say di commission no understand di data privacy law well.

Di commission tok say Meta suppose first get approval before dem fit carry any personal data comot Nigeria – Meta say dis kain condition na "unrealistic".

Di data commission still give oda demands.

Dem tell Meta make dem put one icon wey go link to educational videos about data privacy risks. Dis kind video go be content wey Meta go do together wit goment-approved schools and non-profit organisations.

Di NDPC still tok say di videos must show di danger of "manipulative and unfair data processing" wey fit put Nigerian users for health and money kasala.

Meta tok say di NDPC demands no make sense and say di agency no sabi interpret di law wey guide data privacy well.

Dis article originally report say Meta bin tok for court papers say pipo for Nigeria fit lose access to Facebook and Instagram.We don update dis tori to attribute di source of dis quote to Africa Report.