Burkina Faso dump visa fees for all African travellers

Read am in 3 mins

Burkina Faso don announce di introduction of free visa system for visitors from African kontris.

Dem reach dis decision on Thursday, wen dem do council of minister meeting wey di junta leader Capt. Ibrahim Traoré bin lead.

From di meeting, Burkina Faso agree say dis decision go help di movement of pipo and goods within di kontri.

Dis new decision under junta leader Traoré make di kontri join di league of oda African kontris wey dey allow free visa.

According to Mahamadou Sana wey be Burkina Faso Minister of Security, dis new free visa for African kontris means say visitors from dose kontris no go pay any visa fees.

"From now on, any citizen from African kontris wey wish to go to Burkina Faso no go pay any amount to cover visa fees."

African visitors go howeva dey required to submit online visa application, wey go dey reviewed for approval, according to wetin di minister tok.

Di West African nation don join kontris like Ghana, Rwanda and Kenya, wey don make am easy for African visitors to travel witout hard requirements.

According to di information from di govment service, to scrap visa fees for di nationals from African continent show say Burkina Faso dey attached to Pan-Africanist ideals, and promotes regional integration.

Burkina Faso say part of dia aim na also to promote tourism for dia kontri.

"Dis free visa system for African nationals go also help promote tourism and Burkinabe culture, and improve Burkina Faso visibility abroad," according to statement from di govment information service.

According to di Minister of Security, wen visitor submit dia online application, dia request go dey subjected to review and approval.

Meanwhile, Burkina Faso as Sahel nation dey currently face security threats from insurgents.

Traore na young soldier wey dem dey praise sake of im Pan-Africanist stand since e seize power for 2022 coup.

Traore dey admired for di continent for im charismatic leadership as im popularity dey fuelled through social media, including many misleading posts wey tend to boost im image.

But Oga Traoré don also face criticism for im authoritarian style of govment, and also for di ongoing Islamist insurgency.

Burkina Faso dey battle armed jihadist groups, wit estimated 40% of di kontri under di control of di groups.

Howeva, dis new announcement of free visa fees for African travellers to Burkina Faso go also totori young pipo wey dey follow Traore.

Earlier dis year, Ghana say all African passport holders go dey able to visit witout visa.

Last year, Kenya bin introduce "visa-free" policy wey most visitors to apply online for authorisation bifor dem leave dia kontri.

African visitors to Rwanda also no need visa to enta di kontri.

Burkna Faso dey hope say dis new free visa decision go help dia economy and also build dia image for global stage.