You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump say America go boycott G20 wey South Africa dey host
- Author, André Rhoden-Paul
- Read am in 3 mins
Donald Trump don announce say US no go attend di G20 summit for South Africa on top one widely discredited claims say dem dey oppress white pipo for di kontri.
Di US president tok say, na "total disgrace" say South Africa dey host di meeting, wia leaders from di world largest economies go gada for Johannesburg later dis month.
South Africa foreign ministry describe di decision of di White House as "regrettable".
No South Africa political parties - including those wey represent Afrikaners and di white community in general – don claim say genocide dey for South Africa.
Trump bin post on im social media platform Truth Social say: "Na total disgrace say dem go hold G20 for South Africa.
"Dem kill and slaughter Afrikaners (pipo wey come from Dutch settlers, and also French and German immigrants) dem collect and seize dia land and farms illegally," e write.
"No US govment official go attend as long as dis human rights abuses continue."
Trump bin earlier tok say South Africa no suppose dey for G20 at all, and e say im go send vice-president JD Vance, instead of make im attend imsef.
But now, di White House don tok say no US official go attend.
Every year, one different member state dey host di G20 and set di agenda for di summit - US suppose host am next afta South Africa.
Di South African foreign ministry for statement say: "Di South African govment wish to state, for di record, say di characterisation of Afrikaners as an exclusively white group dey ahistorical.
"Furthermore, di claim say dis community dey face persecution, no dey based on fact."
Since e return to office for January, Trump don repeatedly accuse South Africa say dem dey discriminate against dia white minority, even for May wen e confront South Africa President Cyril Ramaphosa for di Oval Office.
Di Trump administration don give Afrikaners refugee status, e declare say "genocide" dey hapun for South Africa.
Last week, di White House bin announce plans to limit refugee admissions for a record low, and give priority to white South Africans.
South Africa govment tok say di claims of white genocide dey "widely discredited and no dey supported by reliable evidence" and point to di "limited uptake" of dis offer by South Africans.
One South African court for February bin dismiss di claims as "clearly imagined."
Dem start G20 for 1999 afta di Asian financial crisis. Di nations wey dey involved get more dan 85% of di world wealth and dia aim na to restore economic stability.
Dem hold di first leaders summit for 2008 in response to dat year global financial turmoil, to promote international co-operation.
Now di leaders dey get togeda each year - along wit representatives of di European Union and African Union - to tok about di economies plus di issues countries dey face.
Dis dey come as Trump don also draw ear give West African country Nigeria and designate am as "country of particular concern (CPC), ontop claims say dem dey kill Christians for Nigeria.