Company appoint female AI robot as 'experimental' CEO

Company appoint female AI robot as 'experimental' CEO

Wia dis foto come from, Reuters

One company wey dey produce drink for Poland don appoint wetin dem describe as di world first artificial intelligence robot as ‘experimental’ chief executive officer, Reuters report.

Di company, Dictador, tok say di technology wey her name na Mika still dey on probation but she go lead di company growth into one-off collectables, communication or even strategy planning.

Mika tok say she dey bring sometin to di job wey human being no fit bring.

“My decision-making process rely on extensive data analysis and to align wit di company strategic objectives. Personal bias no dey, na to ensure unbiased and strategic choices wey prioritise di best interest of di organisation.

President of Dictador Europe Marek Szoldrowski confirm say Mika na di CEO and add say data-driven capabilities and oda tins wey she dey bring to di company na great advantage for dem.

E tok say AI no fit fully replace human executives but di world no fit ignore dem.

“Na bright future, and we dey live for very dynamic-changing world, so na quest. For us na quest, wetin go be di future of di companies like our own. So we simply say e worth am to involve AI.

Szoldrowski tok say concern no dey say artificial intelligence fit hire or fire pesin. E tok say significant decisions still dey for di hand of humans executive team.

Mika tok say as robot CEO, she no really get weekend and she dey on 24/7 ready to make executive decisions and ginger some AI magic.

“But hey, I no mind. I come hear to help Dictador take ova di world,” she tok.

Company appoint female AI robot as 'experimental' CEO

Wia dis foto come from, Reuters

Dis no be di first time wey robot go dey make headline.

Last year October, tech billionaire Elon Musk bin show prototype of one humanoid robot wey im Tesla electric car company dey develop.

Optimus bin appear on stage for one Silicon Valley event, wia e wave to di audience and raise im knees.

Di CEO say di robot na work-in-progress but fit dey on sale to di public in some years time.

Tesla mass-market robots go dey tested by working jobs for di car factories, na so di company engineers dey tok.

Dem roll di prototype on stage for di annual Tesla AI [artificial intelligence] Day presentation.

But experts including di heads of OpenAI and Google Deepmind bin sama warning before now say artificial intelligence fit lead to di extinction of humanity.

Plenty pipo bin support one statement dem publish on di webpage of di Centre for AI Safety.

"Mitigating di risk of extinction from AI suppose be global priority alongside oda societal-scale risks like pandemics and nuclear war," di statement tok.

But odas say dem don too overblow di fears.

Sam Altman, Chief Executive of ChatGPT maker OpenAI; Demis Hassabis, Chief Executive of Google DeepMind; and Dario Amodei of Anthropic don support di statement.