Meet new cabinet ministers Kenyan President William Ruto appoint

New Kenya ministers

Wia dis foto come from, TWITTER

President William Ruto of Kenya on Tuesday don appoint im cabinet ministers and advisers afta im win di 9 August presidential elections.

Di President retain one serving cabinet secretary, Musalia Mudavadi wey im appoint as di prime cabinet secretary.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Im also appoint di former Central Bank of Kenya (CBK) Govnor Njuguna Ndung’u as di cabinet secretary for di National Treasury.

Ndung'u na economics professor wey lead di central bank between 2007 and 2015,.

Di professor win winning praise sake of say im preside ova di expansion of di financial sector.

E also chop criticism sake of say im give priority to growth ova price stability for 2011.

Below na list of ministers wey di President appoint:

  • Interior and National Administration- Prof Kithure Kindiki

Prof Kithure Kindiki come from Irunduni village, for Tharaka Constituency. Im start im career for academia. Im acquire im Bachelor of Laws degree from Moi University, and later earn im master's degree in International Human Rights Law and Democracy and a PhD in International Law. Im earn both degrees from di University of Pretoria, South Africa.

Prof Kithure Kindiki go im Twitter page yesterday to announce say im dey ready to serve.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

  •  National Treasury and Planning - Prof Njuguna Ndung’u

Prof Ndung’u na leading figure for di crafting of United Democratic Alliance (UDA) manifesto wey dem name di Plan.

Im bin serve as Executive Director of di African Economic Research Consortium (AERC) wey dey responsible for di drafting of di Kenya Kwanza economic model afta im appointment for 2021.

  • Public Service and Gender- Aisha Jumwa Katana

Aisha Jumwa Katana na politician and di current Member of di Parliament, Malindi Constituency.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

  • Defence - Aden Duale

Aden Duale na Garissa Town MP.

Di MP express im gratitude to President William Ruto afta im appoint am as Defence Cabinet secretary.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 4

  • Water, Sanitation, and Irrigation – Alice Wahome

Alice Wahome na Kandara MP. Di second term MP na lawyer and rights campaigner.

Skip X post, 5
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 5

  • Foreign and Diaspora Affairs - Alfred Mutua

Alfred Mutua na di immediate former Govnor of Machakos.

Skip X post, 6
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 6

Below na list of oda ministerial nominees:

  • Trade, Investments, and Industry - Moses Kuria
  • East African Community - Rebecca Miano
  • Roads, Transport and Public Works - Kipchumba Murkomen
  • Environment and Forestry - Roselinda Tuya
  • Lands, Housing and Urban Development - Zacharia Mwangi Njeru
  • Tourism, Wildlife, and Heritage - Penina Malonza
  • Agriculture and Livestock - Mithika Linturi
  • Health - Susan Wafula
  • Information, Communications and Digital Economy - Eliud Owalo
  • Education - Ezekiel Machogu
  • Energy and Petroleum - Davis Chirchir
  • Youth Affairs, Sports and The Arts - Ababu Nawamba
  • Cooperatives and Micro, Small, and Medium Enterprise (MSME) development - Simon Chelugui
  • Mining, Blue Economy and Maritime Affairs - Salim Mvurya
  • Labour and Social Protection - Florence Bore

Di President also appoint former National Assembly Speaker Justin Muturi as di Attorney General, Mercy Wanjau as Secretary to di Cabinet, Monica Juma as National Security adviser and Harriet Chigai as di Women Rights Agency adviser. President Ruto cabinet ministers and advisers include 10 women and elected politicians.

Di president bin promise 50% appointments to women but out of di 22 ministers, only seven be women. E appoint two more women as advisers and one female secretary to di cabinet.

Some pipo dey see di appointments as reward for im loyalists wey campaign for am across di kontri.

Politicians don make grand comeback to di cabinet afta di previous administration.

For di last administration where Ruto be Vice President, technocrats nai full di executive.

By-elections go dey for areas wia di senators and MPs wey Ruto appoint dey represent.