'First time wey my odeshi dey fail me' - Herbalist wey shoot customer wey do odeshi say na mistake

Herbalist Danladi Yau wey Nigeria Police arrest for Bauchi state tok say na mistake make am shoot to death im client wey come collect gun charm from am.
Danladi bin ask late Muhammadu Ali to hold chicken for im hand for im to shoot di chicken wit a gun in order to prove say di juju dey work but unfortunately di bullet hit Ali for bele.
Herbalist Danladi Yau wey Nigeria Police arrest for Bauchi state tok say na mistake make am shoot to death im client wey come collect gun charm from am.
Danladi bin ask late Muhammadu Ali to hold chicken for im hand for im to shoot di chicken wit a gun in order to prove say di juju dey work but unfortunately di bullet hit Ali for bele.
For video wey Bauchi State Police Command post on dia Facebook Page, di herbalist tok say e don arrange di charm against gunshots for plenty pipo and dis na di first time e fail am.
“Wen dem come meet me say dem wan gun charm I bin give dem some tins to go use first, some to chew and oda ones na smoke for dem to use on dia body.
“By di time dem return I ask dem if dem carry out all my instructions and dem answer yes wey make me say oya make we try am. In fact na dem even bring gun come.”

Late Ali na resident of Damaiwa village wey dey Zaki local goment area of di state.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na for Damaiwa bush im and im three friends go meet herbalist Danladi to get protection from gun shots.
“Di area wey dem stay get security wahala so na why dem feel say dem wan get protection from gun shots and knives,” Di herbalist tok for di video.
“Personally I dey feel say na some pipo make my work fail becos all di odas I do before even clothes e no tear talk more of killing pesin.”
Dem shoot one man to death for Bauchi state wia one traditional healer dey test odeshi charm for im bodi.
Di police tok tok pesin for di state Ahmed Wakil confam di incident say dem dey test di charm to see if gun go enta di man bodi.
Di herbalist dey try di charm wen im shoot one locally made gun, but na straight death follow di gunshot wey dem fire.
Police bin arrest di herbalist wit two oda suspects and oda suspects dey on di run.
Wakil say di 43-year-old village man Muhammadu Ali bin dey try to see if di charm wey dem do for am dey effective.
Police rush go di area wen dem hear di sound of gun wia dem quickly rush Ali go hospital. Dem announce di man dead on arrival.

SP Ahmed Wakil yarn say nothing like mistake for law and therefore di herbalist must face di court of law.
“Our officers rush to di scene of di incident moments affer e happun and na from dia dem rush di victim to hospital wia doctors pronounce am dead.”
“Nothing like mistake for law pesin wey commit must face di music so we dey prepare every and soon we go charge di herbalist to court to answer for wetin e do.”
“I be Police officer for many years and wetin i go tell pipo be say nothing like gunshot charm wey dey exist all na just scope.”
Odeshi na one charm wey many pipo dey try use protect diasef wia dem go consult traditional herbalist to do am for dem but many pipo don also die from di gun testing.
Di police warn against such occurrence as dem go charge di suspects go court after dey conclude investigations.
Dem don since bury Late Ali according to muslim rites for im Damaiwa village.














