You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Dis na dream come true' - Ghana dancers Afronitaa, Abigail tok afta third place for Britain’s got talent
Two dance sensations from Ghana wey qualify for di final of 2024 Britain’s got talent don chop third for di final on Sunday.
Afronitaaa and Abigail Dromo di hearing impaired seven year-old beat stiff competition from eleven oda finalists.
28 year-old singer Sydnie Christmas don win di ultimate afta im performance blow di judges away.
Sydnie perform ‘over di rainbow’ by Harold Arlen wit high pitch wey im get standing ovation.
Afta di public votes, Sydnie wey bin act for young age bifor im begin to sing, don win di 17th series of di show.
For im package, Sydnie win £250,000 cash.
Sydney wey neva fit to hold back im tears tok say “I no fit believe di love wey I don feel since my last performances. I wish say one day everyone go feel dis same way.”
Jack Rhodes wey be magician don chop 2nd.
End of Di one wey oda users dey read well well
Opera singer from South Africa Innocent Masuaku don chop 4th.
For Afronitaaa and Abigail wey be di only Africans for di top three, dis na big achievement for dem.
Aftonitaaa tok say she dey grateful to everybodi wey support dem.
“Dis na di most beautiful journey ever, dis na dream come true”.
Di journey of dis two female dancers don blow pipo away afta dia first addition video go viral.
Di two don impress Simon Cowell and all di oda judges wit dia skill and entertaining choreography.
Dis na di first time dancers from Ghana dey participate for dis competition wey dem progress to di final.
Dem hope say dia journey go inspire oda going pipo for Africa say “everybody im dreams dey valid and no matter di circumstance, pesin go fit to shine.”
Back home for Ghana, everibodi dey hail di two young dancers for dia achievement.
Former Ghana president John Mahama don tok say di two girls put di kontri for di world stage.
“You girls give we anoda reason to be proud of our kontri Ghana and di talent and creativity of di youth.”
Vice president Dr Mahamudu Bawumia also write for Facebook say Afronitaaa and Abigail na “shinning ambassadors for Ghana wit your ogbonge display.”
For di wife of di Vice president, Samira Bawumia, di two girls “na great source of pride”.
Road to di final
Di two dancers don impress di judges for dia first audition - performance wey make dem cry.
for dia semi-final performance, Afronitaaa and Abigail feature serious dance choreography from Ghana musician wey dey inside UK, FUSE ODG and Beyoncé.
Dis time FUSE ODG also dey inside di audience togeda wit Afronitaaa and Abigail dia families.
For di second time, di judges give dem standing ovation as di crowd jam to dia performance from di beginning to di end.
Afta Thursday performance, dem talk say Afronitaaa and Abigail don win di semi-final round of di night by vote, na so dem qualify for di finals on Sunday 2 June 2024.
Musician FUSE ODG tok say im make proud say dem use im song take perform for dis stage.
“As a musician e sweet well-well say I dey inside di audience, na phenomenal performance.”
Im add say, “I dey proud of you guys and you don make Ghana proud”.
Di mama of di 7-year-old dancer don dey overjoyed about im pikin im achievement.
“I make happy pass wey I dey grateful to God for dis. Make Ghana pipo expect something big for di final on Sunday.”
For Ghana, everybody dey hail di two dancers for dia achievement wey dem dey pray say make dem win di final.
Popular YouTuber Wodemaya write for Facebook say “Afronitaaa and Abigail really dey take Africa to di world and making Ghana proud”.
Di Ghana tourism authority tok say make pipo support di two dancers to glory.
“Make we all support dem as dey lift di flag of Ghana high once again. We don dey proud of dem.”
Dis na historic feat as Afronitaaa and Abigail be di first Ghanaian dancers wey reach dis stage for di show.
Di Ghanaian dancers bin trend afta dia amazing performance for Britain’s Got Talent audition wey happun on Saturday, 4 May.
Afronitaaa im former colleagues for DWP Academy wey don rally support for am don write on instagram say dem dey proud of am.
Fellow dancers like Endurance Grand, Lisa Quama and Champion Rollie all hail im achievement.
Dancegod Lloyd also celebrate Afronitaaa and Abigail dia performance for di competition.
Afronitaaa wey be ogbonge dancer and seven year-old Abigail, wey no fit to tok or hear, bin show di judges wetin dance choreography from Ghana dey look like.
For di 2023 finals, Ghetto kids from Uganda bin finish 6th.
Dem miss out on di top three slots.
Di group of six children wey dey between di age of six and thirteen years old bin get one smooth run through di year edition of di highly contested competition till dem reach di grand finale.
For April, di Ghetto Kids gbab news headlines afta dem win golden buzzer for di return of Britain's Got Talent 2023 competition.
Dem dance on one customized stage to showcase one typical local Ugandan village homestead, di group manage to put on a performance to remember for di semi-finals.
Dia showcase of ogbonge choreography catch di attention of di world and dem continue to cruise through di semi-finals as di first act to reach di finals.
Who be Afronitaaa and Abigail?
Afronitaaa na dance artist and choreographer for Ghana wey begin dey dance professionally by di time im dey 14 years.
Im dey part of dance group DWP Academy from 2018 before im decide to leave in 2024 to start im own dance academy for kids.
At 20 years, Afronitaaa don dey pursue business administration for di University of Ghana, wey im dey combine wit dance.
For di six years wey im dey dance, Afronitaaa get ova six million followers across im social media, wia im collaborate wit plenty brands and musicians for Ghana, Nigeria, Tanzania, Barbados, France, Dubai and di UK.
Afronitaaa say im dey “specialise for Afropop wey be mixture of Afrodance wit oda popular dance from oda genres.”
Abigail Adjiri na winner of one talent show for Ghana.
Di dancer win TV3 Talented kids show for August 2023.
Despite say im no dey hear and no fit to tok, Abigail beat competitions for dat show wey im win.
Dem born Abigail with hearing impairment.
But recently, im get hearing aid wey dey fit help am to hear small sounds inside one ear.
But wit im dance talent, Abigail don become national star afta im win di TV3 talent show.