Messi beat Haaland, Mbappe, Osimhen and odas to win Ballon d’Or award 2023

Lionel Messi

Wia dis foto come from, BBC Sport

Inter Miami player Lionel Messi don win dis year Ballon d’Or’ award.

Messi, aged 36 beat 30 oda players dem bin shortlist for di award afta e inspire Argentina go di 2022 World Cup glory for Qatar last December.

Di Inter Miami forward lift di individual trophy for a record-extending eighth time, while Manchester City striker Erling Haaland come second.

"All of dem dey special. E dey to nice to dey here once more to enjoy dis moment, to fit win di World Cup and achieve my dream."

Messi pick up di award for a record eighth time afta im help im kontri win di World Cup for Qatar for December.

Di top 10 footballer in di world for 2023 na;

Lionel Messi, Erling Haaland Kevin De Bruyne and Kylian Mbappe and

Rodri (Manchester City & Spain)

Vinicius Junior (Real Madrid & Brazil)

Julian Alvarez (Manchester City & Argentina)

Victor Osimhen (Napoli & Nigeria)

Bernardo Silva (Manchester City & Portugal)

Luka Modric (Real Madrid & Croatia)

For di womens award, na Spain and Barcelona midfielder Aitana Bonmati win am for winning di World Cup for La Roja dis summer.

25 year old Bonmati, beat Australia and Chelsea striker Sam Kerr to first place.

Her teenage team-mate for club and country, Salma Paralluelo, carry third.

Last season, na former Real Madrid captain Karim Benzema win di Ballon d’Or while Barcelona Alexia Putellas win di women award for a second straight year.

Dis na wetin you need to know ahead of di award ceremony:

Wen be di Ballon d’Or award?

2023 Ballon d’Or

Wia dis foto come from, Getty Images

Di 67th annual Ballon d’Or ceremony go take place on Monday 30 October 2023. E dey expected to start by 7:00pm West African Time for di Theatre du Chatelet for Paris.

How to watch di Ballon d’Or?

Di ceremony go dey live on DSTV sport channel, Supersport for Nigeria and Ghana.

Na Chelsea legend Didier Drogba go host di ceremony.

Who be di Ballon d’Or nominees?

Men Ballon d'Or 2023 nominees

Josko Gvardiol (Manchester City)

Andre Onana (Manchester United)

Karim Benzema (Al Ittihad)

Jamal Musiala (Bayern Munich)

Mohamed Salah (Liverpool)

Jude Bellingham (Real Madrid)

Bukayo Saka (Arsenal)

Randal Kolo Muani (Paris Saint Germain)

Kevin de Bruyne (Manchester City)

Bernardo Silva (Manchester City)

Khvicha Kvaratskhelia (Napoli)

Emiliano Martinez (Aston Villa)

Ruben Dias (Manchester City)

Nicola Barella (Inter Milan)

Erling Haaland (Manchester City)

Yassine Bounou (Al Hilal)

Martin Odegaard (Arsenal)

Julian Alvarez (Manchester City)

Ilkay Gundogan (Barcelona)

Vinicius Jr (Real Madrid)

Robert Lewandowski (Barcelona)

Antoine Griezmann (Atletico Madrid)

Lautaro Martinez (Inter MIlan)

Lionel Messi (Inter Miami)

Rodri (Barcelona)

Kylian Mbappe (Paris Saint German)

Kim Min-Jae (Bayern Munich)

Victor Osimhen (Napoli)

Luka Modric (Real Madrid)

Harry Kane (Bayern Munich)

Women Ballon d'Or 2023 nominees

Alba Redondo (Levante Union Deportiva)

Kadidiatou Diani (Lyon)

Rachel Daly (Aston Villa)

Linda Caicedo (Real Madrid)

Fridolina Rolfo (Barcelona)

Olga Carmona (Real Madrid)

Amanda Ilestedt (Arsenal)

Hayley Raso (Real Madrid)

Georgia Stanway (Bayern Munich)

Sophia Smith (Portland Thorns)

Hinata Miyazawa (Manchester United)

Salma Paralluelo (Barcelona)

Lena Oberdorf (Wolfsburg)

Millie Bright (Chelsea)

Daphne van Domselaar (Aston Villa)

Sam Kerr (Chelsea)

Patricia Guijarro (Barcelona)

Ewa Pajor (Wolfsburg)

Debinha (Kansas City)

Guro Reiten (Chelsea)

Yui Hasegawa (Manchester City)

Aitana Bonmati (Barcelona)

Jill Roord (Manchester City)

Alexandria Popp (Wolfsburg)

Katie McCabe (Arsenal)

Mary Earps (Manchester United)

Wendie Renard (Lyon)

Mapi Leon (Barcelona)

Asisat Oshoala (Barcelona)

Khadija Shaw (Manchester City)

Kopa Trophy 2023 nominees

Rasmus Hojlund (Manchester United)

Jamal Musiala (Bayern Munich)

Alejandro Balde (Barcelona)

Pedri (Barcelona)

Jude Bellingham (Real Madrid)

Antonio Silva (Benfica)

Eduardo Camavinga (Real Madrid)

Xavi Simons (RB Leipzig)

Gavi (Barcelona)

Elye Wahi (Lens)

Yachine Trophy 2023 nominees

Emiliano Martinez (Aston Villa)

Mike Maignan (AC Milan)

Thibaut Courtois (Real Madrid)

Aaron Ramsdale (Arsenal)

Yasssine Bounou (Al Hilal)

Andre Onana (Manchester United)

Dominik Livakovic (Fenerbahce)

Marc-Andre Ter Stegen (Barcelona)

Ederson (Manchester City)

Brice Samba (Lens)