Why British singer Adele dey step away from music ‘for a long time’

Wia dis foto come from, Getty Images
British popular singer, Adele announce say she wan take “long time career break” afta her incredible journey as global musician and performer.
Di Grammy awardee, wey dey popular for her R&B songs tell her fans afta her performance for Munich say she go hold dem dear during di period of her break.
“I no go see una for a long time and I go hold una dear to my heart for di whole length of my break and I go fantasise about dis shows," she tok.
She explain say she go need to “rest” and take some personal time afta she don spend seven years "building new life for mysef, and I wan live am now. I wan live my new life wey I don dey build".
Di 36-year-old singer wey come from London become global artist afta her second album “21” wey top charts across di world and win am her first Grammy award.
Di "Hello" singer wey get ova16 Grammy awards and 25 nominations tok say she go wrap up her next performance for Las Vegas to end her shows afta two year of performing.
“I don really enjoy performing for nearly three years now, wey be di longest I don eva do and probably di longest I go eva do,” she tok during her last performance and final show for Munich residency on Saturday, 31 August.
Adele last album "30" for 2021, win Grammy award for "Best Pop Solo Performance" and six nominations for oda categories.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di album na di biggest-selling album for di US afta just one day wey she drop di album, wit "Easy on me" topping charts for UK and US.
For July, Adele bin announce say she dey go on "big break" to do oda creative tins for some time becos she no get plan for "new music at all".
Di musician don dey perform on weekends since November 2022 and she go conclude am for 23 November, 2024.
Recently, Adele announce her engagement to Rich Paul, di duo don dey date since 2021 afta her divorce from Simon Konecki for March 2021. Dia union dey blessed wit one pikin.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Who be Adele?
Dem born Adele Laurie Blue Adkins on 5 May 1988, for London, England, and she rise to fame at di age of 19 years old for 2008 wit her first album "19".
Her second album "21" na di fourth best-selling album of all time for di UK.
She don release four albums "19", "21", "25" and "30" as R&B singer.
Di mother of one (Angelo) divorce her ex-husband, Simon Konecki afta six years of marriage.
Since den, she don dey date Rich Paul, founder of Klutch Sports Group, wey she intend to marry.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2














