You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Authorities shut down Abuja airport afta aircraft comot from runway enta bush
One Cargo aircraft jump comot from runway enta bush for di Nnamdi Azikiwe international airport for Abuja.
Di aircraft wey belong to di Allied Air Cargo wit registration number 5N-JRT jump comot from di runway around 10:05am on December 11, 2024.
For statement wey di Director, Public Affairs and Consumer Protection, Obiageli Orah sign, she tok say di " Allied Air Cargo aircraft wit registration number 5N-JRT bin comot from runway 22 for di Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja wit five souls (pipo) on board wit no reported injury."
She add say dem safely evacuate all of dem as dem carry dem go di Federal Airport Authority of Nigeria (FAAN) clinic to check and make sure say dem dey okay.
Local media report say di incident bin make authorities close di Nnamdi Azikiwe International Airport as e scata flight schedules and cause delays.
Di tin also affect oda airports too sake of say flights wey dey comot from Abuja bin no fit take off. Flights wey dem come Abuja from oda airports too no fit take off.
Dis no be di first time wey dis kain incident dey happun for di Nigeria airports.
Nigeria goment suspend DANA airlines, one local airline for di kontri afta one of dia planes wey bin carry passengers from Abuja enta Lagos bin get one small accident on di runway.
Recently, all di pipo wey dey inside one helicopter wey crash for Bonny, Rivers state die.
Di pipo wey die na di six passengers and two crew members.
Di federal ministry of aviation bin first report di helicopter accident wey happun on Thursday morning 25 October, 2024.
"Di helicopter, a Sikorsky SK76 wit registration 5NBQG and operated by East Wind Aviation, bin dey go from Port Harcourt Military Base (DNPM) to di NUIMANTAN oil rig," di ministry tok for alert wey dem bin issue.
Dem say di aircraft enta inside water near Bonny Finima for di Atlantic Ocean.
Na on Wednesday, 24 April, Nigeria goment bin order di suspension of Dana Air.
For April 2024, Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo bin tok say di Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) go carry out full audit of all local airlines for di kontri.
E say goment go review all di airlines wey dey carry passengers for di kontri, to guarantee di safety of all passengers plus di health of di civil aviation industry.
Di Airport Emergency response team dey di scene along wit accident investigators.
According to di statement, dem still dey clear di runway so dat dem fit reopen am for operations as soon as possible.
Dem dey wait di preliminary report wey di Nigeria Safety Investigation Bureau (NSIB) go release about di incident.