States wey don shutdown schools sake of insecurity wahala

Read am in 7 mins

Yobe state govment don order di closure of all boarding Secondary Schools for di state.

Di state na di latest state for Nigeria to close down schools following di abduction of ova 300 students for schools in Nigeria in recent weeks.

Yobe state govnor Mai Mala Buni say di directive na proactive measure to safeguard students for di schools.

E add say all di secondary schools for di state go remain closed until di security situation for di kontri improve.

Just last week, two major schools abductions happun for northern Nigeria. One for Kebbi state and anoda for Niger state.

Di latest happun for early mormor of Friday, 21 November, as gunmen kidnap 315 school children from Saint Mary's School, wey be Catholic school for Papiri community for Agwara Local Government Area of Niger State.

SP Abiodun, tok-tok pesin of di Niger State police command say di incident happun around 2am wen di students suppose to dey sleep.

One woman wey her daughters dey attend di school but escape di kidnappers tell BBC say, "Evri body dey weak... e take evri body by surprise."

One distressed woman wit tears tell BBC say di gunmen kidnap her nieces, aged six and 13, she add say: "I just want make dem come home."

Police say security agencies dey "comb di forests wit hope to rescue di abducted students".

Few days earlier, 18 November, gunmen bin storm Government Girls Secondary School, Maga, for Danko/Wasagu Local Government Area of Kebbi State, north-west Nigeria kill one teacher and Kidnap 25 girls.

"Around 3:30am we hear gunshot, but we tink say na local vigilante dem wey dey patrol."

"Later we hear heavy gunshot around 4:30am, and wen I comot, we see pipo dey run comot from di school wia di bandits enta do di attack."

Kidnapping of pipo for ransom by criminal gangs, known locally as bandits, don bicom major problem for many parts of Nigeria.

Although, govment don ban di payment of ransom as way to cut di supply of money to di criminal gangs - but e no too get effect, as these bandits still dey kidnap pipo and demand for ransom.

Also, for dat same week, jaguda pipo attack one church for Kwara state, north-central Nigeria, kill two pipo and kidnap 38 odas.

List of schools govment don order dia closure

Following these series of abductions for schools, some schools don order for closure and order all dia students to go back house.

These na some of di states where schools don close:

Kebbi state: Di Kebbi state govment don order di closure of all public, private secondary schools plus all tertiary institutions across di state, except di College of Nursing Sciences, Birnin Kebbi.

Di state Commissioner for Higher Education, Issa Abubakar-Tunga and di Commissioner for Basic and Secondary Education, Halima Bande announce am inside one statement.

Di commissioners tok say di closure of di schools don bicom necessary following di recent cases of attacks for parts of di state.

Dem list di affected tertiary institutions to include:

  • Kebbi State Polytechnic Dakingari
  • Abdullahi Fodio University of Science and Technology, Aliero
  • College of Health Sciences and Technology, Jega
  • Adamu Augie College of Education Argungu, and School of Remedial Studies Yauri

Katsina state: Di state govment don order make all public primary and secondary schools for di state shut down.

Di Commissioner for Basic and Secondary Education, Yusuf Suleman Jibia, announce say di directive apply to evri boarding secondary school and all oda schools across di state.

Di move na to strengthen security and protect di education system, Jibia tok.

E tok say di decision to close di schools na precautionary measure sake of di security wahala for some parts of di kontri.

Di Commissioner add say di closure go remain until security conditions dey safe for normal teaching activities to start again.

Yobe state: Yobe state govment also order di closure of boarding secondary schools for di state sake of security challenges.

Kwara state: Di state govment order make schools for four local govment areas close sake of insecurity wey dey rise for some communities.

Di Nigeria Union of Teachers (NUT), Kwara State branch release announce di govment decision on Wednesday.

Di NUT Chairman, Yusuf Agboola, tok say schools for Isin, Irepodun, Ifelodun and Ekiti LGAs go shut down.

Agboola explain say di union dey follow strict instruction from di Ministry of Education and Human Capital Development after govment raise concern about new security threats wey dey happun for Kwara South.

Niger state: Di state govment order di closure of all public and private Primary and Secondary Schools across di state.

Govnor Bago wey announce di informate on Saturday, 22 November, tok say di order to shutdown include all Missionary, Islamic Schools and Federal Government Colleges including FGC Minna, until further notice.

Tertiary Institutions no dey affected, except for dos wey dey for defined vulnerable areas for Niger North and East Senatorial Districts respectively, e add.

Taraba state: Di govment direct all public and private secondary schools wey dey boarding facilities to deboard dia students wit immediate effect.

For one statement, wey di govment release on dia official X account on Saturday, 22 November, e say decision dey come afta one security review wey examine recent attacks on boarding schools for parts of Kebbi and Niger States. E say di reports put boarding students among di most vulnerable targets for di current wave of insecurity wey dey affect some parts of di kontri.

Di statement wey di Commissioner of Information and Re-orientation Zainab issue say di govnor Agbu Kefas don approve a temporary shift from boarding to day-school operations across di state.

Bauchi state: Di state govment don announce di closure of all primary, secondary, and tertiary institutions, including federal govment owned and private schools for di state wit immediate effect.

One statement wey di govment issue tok say dem take di decision afta extensive consultations and in response to di serious security kasala wey dey affect di safety of students, teachers, and school communities across di state.

Meanwhile, di Nigeria govment don describe as fake news tori wey dey fly up and down say govment say make all schools nationwide close from 24th November.

On Friday, 21 November, tori bin spread say di Nigerian govment don order di immediate shutdown of 47 Federal Unity Colleges across di kontri sake of di kidnapping incidents wey happun for Niger and Kebbi states.

To clear di mata, di Federal Ministry of Education for one statement on dia official X account tok say, "di tori dey false, misleading, and no come from di federal govment."

Di statement wey di tok-tok pesin for di ministry Boriowo Folashade sign, say make kontri pipo ignore di informate as e no come from dem.

Nigeria don witness many school abductions bifor these recent ones.

Di militant Islamist group Boko Haram bin kidnap 276 girls from dia school for di town of Chibok, Borno state for 2014.

Di incident catch international attention and spark one global campaign wey call for dia return, wey include intervention from then-US First Lady Michelle Obama.

However, dis latest mass abduction dey come afta claims by right-wing politicians for di US, including President Donald Trump, say Christians dey face persecutions for Nigeria - one allegation wey di Nigerian govment dismiss.

For months, campaigners and politicians for Washington dey allege say Islamist militants dey systematically target Christians for Nigeria.

For early November, US President Donald Trump bin tok say im go send sojas enta Nigeria "guns a-blazing" if di kontri president "continue to allow di killing of Christians".

Di Nigerian govment don call claims say Christians dey face persecution "gross misrepresentation of reality".

One official say "terrorists dey attack all di pipo wey reject dia murderous ideology - Muslims, Christians and dos of no faith alike".

For di north-east, jihadist groups dey battle di state for more dan one decade.

Organisations wey dey monitor violence say most of di victims of these groups na Muslim bicos most attacks dey happun for di northern part of di kontri wey Muslims plenty put.

For di centre of Nigeria, frequent deadly attacks between herders - wey be mostly Muslim - dey happun wit farmers, wey be mostly Christian.

Times wey dem close schools sake of bandits attack for Nigeria

Di last time wey Nigeria close schools sake of bandits attack na for Abuja 2022.

Dem tell all schools make dem shut down and send children go house sake of security wahala for Abuja and Nasarawa state.

Dat time, intelligence reports say armed groups dey plan attacks for different states, including di capital city.

For some years now, schools especially for northern Nigeria don turn target for kidnapping gangs, and dem don hold hundreds of students for ransom.

For 2021, schools for northern Nigeria see increase attacks from armed criminals wey abduct hundreds of students for Katsina state.

Di kidnappers bin carry more dan 300 boys from one school for Kankara area for December, but later release dem.

Authorities for Katsina come order all public boarding schools make dem close bicos attacks for schools for north-west don increase.

For 2020, many states for northern Nigeria also order schools to close afta hundreds of pupils bin kidnap for Katsina state.

Kano, Kaduna, Zamfara and Jigawa follow Katsina close schools afta di attack.

Boko Haram, di Islamist militant group, claim say na dem do di raid.