Ex-Oyo State govnor Rashidi Ladoja become 44th Olubadan of Ibadanland

Wia dis foto come from, Seyi Makinde
Former Govnor of Oyo State, Rashidi Ladoja, don officially receive im crown as di 44th Olubadan of Ibadanland.
Rashidi Ladoja bin receive di crown for di Ose Meji Temple for di Ibadan Southeast Local Govment Area of di state.
Na thousands of pipo bin gada for Ibadan, Oyo State capital Southwest Nigeria as di coronation take place.
Nigeria President Bola Tinubu and oda ogbonge pipo attend di event wey take place for Mapo Hall, badan, Oyo State.
Di Olubadan of Ibadanland na im be di most respected traditional leader for Ibadan, and 43 kings don reign bifor di current Oba Rashidi Ladoja.

Wia dis foto come from, Sunday Dare
Ibadan na di political capital of present day Oyo State for southwest Nigeria and na im be di third largest city by population for Nigeria afta Lagos and Kano.
Di city of Ibadan don tanda for hundreds of years for history and pipo wey dominate Ibadan na Yorubas wit pipo from oda parts of Nigeria wey also dey live for di city.
Wit dis, di Ibadan pipo no dey take dia king play as dem respect am fully.
Di current Olubadan of Ibadan Oba Rashidi Ladoja dey take ova from di late Oba Owolabi Olakulehin wey bin join im ancestors earlier dis year.
Oba Olakulehin die at di age of 90 as celebrations for im 90th birthday and di first anniversary of im reign as Olubadan of Ibadanland bin dey hapun.
Di late Olakulehin become di 43rd Olubadan for 2024, afta e take ova from Oba Lekan Balogun.
Who be Rashidi Ladoja
Oba Rashidi Ladoja na former govnor of Oyo State from 2003 to 2006 and from 2006 to 2007.
For August 2025, dem officially approve am as di 44th Olubadan-designate and im coronation ceremony dey happun one day afta im 81st birthday.
During Nigeria Third Republic, dem elect Ladoja to di Senate of Nigeria for 1993.
Ladoja later become di govnorship candidate for Accord party for Oyo State during di 2011 and 2015 elections, but e no win.

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X









