How Trabzonspor fans attack Fenerbahce players afta Turkish Super Lig loss

Wia dis foto come from, Getty Images
Trabzonspor fans bin run enta field and attack Fenerbahce players afta dia Sunday Super Lig match.
Kasala burst as Fenerbahce bin dey celebrate dia 3-2 victory for Papara Park for Trabzon.
Nigeria and Fenerbahce player Bright Osayi-Samuel and Michy Batshuayi bin defend dia self as security services enta di field.
"E no dey acceptable for violence to take place for football pitch - above all, sport na gentlemanship," Turkey Interior Minister Ali Yerlikaya tok.
"We don begin investigate di mata immediately to identify di spectators wey enter di pitch and investigate di incidents wey take place for di end of di match," Im write for X, wey dey formerly known as Twitter.
Fifa President Gianni Infantino say di incident "no dey acceptable at all".
"I don tok am before, and I go tok am again - without exception, for football, all players need to dey safe and secure to play di game wey dey bring joy to so many pipo all ova di world," Im tok.
"I dey call on di relevant authorities to ensure say dis dey respected at all levels and for di pipo wey get hand for dis shocking events for Trabzon make dem hold dem accountable for dia actions."
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Tensions bin start to rise for di 87th minute wen dem start to throw objects inside field afta Batshuayi score wetin prove to be di winner for di visitors.
Nigeria winger Osayi-Samuel, wen bin play for Blackpool and Queens Park Rangers bifor, knack one pitch invader for ground while former Chelsea forward Batshuayi kick another fan as di players try to defend demself from opposition fans.
Di Turkish Football Federation call di events "unacceptable" and dem tok for statement say "dem go sama those wey dey responsible for dis incidents wit di necessary criminal sanctions ".
Dis na di latest for series of controversial incidents for Turkish league during di 2023-24 season.
For December, MKE Ankaragucu President Faruk Koca, bin hit referee Halil Umut Meler, dat incident bin lead to im suspension for Super Lig fixtures.
Fenerbahce dey siddon second for Super Lig, two points behind leaders Galatasaray and 30 clear of Trabzonspor wey dey third.













