Who go win di Premier League wit 10 games to go?

Premier League title race graphic 2024

Wia dis foto come from, BBC Sport

Afta di drama of di draw between Liverpool and Manchester City for Anfield on Sunday, Dis na good time to torchlight di three-way Premier League title race wit 10 games to go.

For di first time since 2014, na just one point dey separate di top three teams afta 28 games wey dem don play - and now e dey look like say dem go drag am reach di end.

Di top three now no go play again for league for three weeks – sake of FA Cup quarter-finals and international break – di league matches go return wen Liverpool play Brighton and Manchester City host Arsenal on Sunday 31 March.

Dis go give fans plenty time to ova-analyse every single permutation - so BBC Sport, togeda wit data experts Nielsen Gracenote, go help to break down di title race match-by-match to see who dey tipped for glory or heartbreak...

Current table

Premier League table as of 10 March

Wetin be di remaining fixtures?

Premier League remaining fixtures afta 10 games

Pep Guardiola City side typically post-Christmas form dey strong as dem aim for English top-flight record of four consecutive titles. Dem get 10 wins from 13 league games since dia December 1-0 defeat to Aston Villa.

As for Liverpool, di 3-1 loss for Arsenal on 4 February still remain dia only league defeat in nine games so far for 2024. Jurgen Klopp team still get trip to Goodison Park for di Merseyside derby to add into dia busy schedule.

For Arsenal, although dem end dis weekend top of di table, Simon Gleave, head of analysis for Nielsen Gracenote say dia Euro Club Index simulations believe say di title battle na "two-horse race", dem rate City and Liverpool higher as well as di Gunners wey get "trickier" fixtures.

Im say: "Arsenal get six matches left against teams for di Premier League top half but five of those games dey away from home. Manchester City and Liverpool also get six matches remaining against teams for di top half of di Premier League, but four of City matches na for home and half of Liverpool games dey at home."

Match-by-match projections

Graphic wey show Man City remaining fixtures
Wetin we call dis foto, Man City trip to Spurs get di lowest percentage win prediction from Nielsen Gracenote
Graphic wey show Liverpool remaining fixtures
Wetin we call dis foto, Nielsen Gracenote predictions don identify away trips to Manchester United and Aston Villa as potential slip-ups for Liverpool
Graphic wey show Arsenal remaining fixtures
Wetin we call dis foto, Nielsen Gracenote projections say Arsenal go drop points against several sides and dem give dem only a 15% chance of beating Man City for dia next game

Which oda time we see di closest 3-way title race?

Na very few occasion wey we don see three-way Premier League title races wia di teams bin dey separated by just two points towards di end of a 38-game season.

2013-14: By as late as 6 May 2014, only two points bin dey separate Liverpool, Man City and Chelsea, but City win dia game in hand to pass Liverpool wey bin stumble - afta Steven Gerrard infamous slip and Crystal Palace comeback – Wey see City snatch di title.

2001-02: On 23 April 2002, Arsenal bin dey lead Liverpool by one point wit Man Utd a further point back. But Arsenal bin get a game in hand and dem bin dey on a run of 11 consecutive wins, dem seal di title by beating United for Old Trafford.

1995-96: For mid-March, wit eight games left, Man Utd bin dey level on 61 points wit Newcastle and Liverpool on 59 points in third. Even though dem don play two games more, Sir Alex Ferguson side see off di challenge of Kevin Keegan Magpies.

Who di prediction models dey suggest say go win di title?

Predicted premier league table
Wetin we call dis foto, Opta 'supercomputer' prediction model dey estimate di probability for each match outcome (win, draw or loss) wit di use of betting market odds and di Opta team rankings - based on historical and recent team performances. Dem simulate dis outcomes thousands of times to create di probabilities.
Premier League

Gracenote estimate di probability of each match outcome - win, draw or loss - by di use of dia Euro Club Index and den dem simulate di rest of di season a million times to create di probabilities.

Wetin happun at dis stage last year?

Graph wey show how di 2022-23 Premier League title race unfolded

Wia dis foto come from, Gracenote

Wetin we call dis foto, Three draws in a row for Arsenal for April 2023 see dem lose momentum for dia title challenge last season as Manchester City carry di trophy

Arsenal title challenge bin start to fade for dis same stage last year.

Gleave say: "Manchester City come into dia own at di end of last season wen di title race change from a 50/50 battle at di beginning of April to a near-certain league title for Pep Guardiola team less dan a month later."

What if dem finish level on points?

Going into Sunday game, di chance say at least two of di three title contenders go finish level on points for di top of di Premier League na 9.4%, according to simulations wey Gracenote run. Di chances say all three of dem go finish level on points na just 0.5%.

If na tie, di league go dey decided on goal difference, den goals scored, den most points for di head-to-head matches, den most away goals for di head-to-head record.

Any tin wey happun, e dey certain say plenty of twists and turns go dey between now and di final day of di campaign on 19 May.