Former Nigeria minister under Buhari, Audu Ogbeh don die

Audu Ogbeh dey speak for mic

Wia dis foto come from, Pius Utomi Ekpei/AFP via Getty Images

Read am in 4 mins

Former Nigeria minister for Agriculture wey also be one time chairman of di opposition Peoples Democratic Party (PDP) Audu Ogbeh don die at di age of 78.

Ogbeh die on Saturday 9 August 2025, according to report wey di Nigeria Television Authority (NTA) bin credit to di family.

NTA say di "Fmr Minister of Agriculture Audu Ogbeh, don die at 78".

Nigeria President Bola Tinubu don send condolence give di family of Ogbeh wia describe am as pesin wey di nation go really miss.

For 2018, wen Ogbeh be Agriculture minister, di goment bin say dem ready to close border to stop pipo wey dey smuggle rice enta di kontri.

E serve as minister under di late Muhammadu Buhari.

"Chief Audu Ogbeh na patriot wey im wisdom, dedication, and pursuit of progress leave mark on Nigeria political landscape."

"E dey always ready wit facts and figures to support im propositions. Di nation go miss im insightful perspectives and wealth of experience", President Bola Tinubu tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

For 2019, di former Minister of Agriculture Ogbeh bin announce say im boss Buhari don approve Rural Grazing Area (Ruga) plan wey go set aside cattle-grazing areas for herders wey dey carry dia cattle waka around.

Ogbeh also dey known for di cassava flour in wheat policy wia bread bakers supposed dey use cassava flour to make dia products.

"Some bakers dey more comfortable wit wheat-only flour. We no hate wheat-based flour, but we fit reduce di volume," Ogbeh tok for one 2019 interview wit Guardian newspaper.

Leaders pay tribute to late Audu Ogbeh

Bola Tinubu

President Bola Tinubu send condolences to di govment and pipo of Benue State for di passing of Ogbeh.

According to di statement by im tok tok pesin, Bayo Onanuga, Oga Tinubu say di late ex minister bin join politics for di 70s as legislator and e become founding member of di All Progressives Congress.

President Tinubu say Ogbeh contributions to policy formulation and im practical solutions to complex national challenges, make am stand out.

Nigeria former President of di Nigerian Senate and Chair of di 8th Nigerian National Assembly, Bukola Saraki describe di late former minister as rare public figure and valuable Nigerian.

For im post for X, Saraki send condolence to di family of Ogbeh for dia loss, say Nigeria don lose voice of reason and heart of service.

"Chief Audu Ogbeh, former Chairman of di PDP and Minister of Agriculture na one of di rare public figures wey im words carry di weight of integrity."

"For im work and my encounters wit am, I see man wey dey deeply rooted in good values and dey genuinely concerned for di interest of di pipo wey e serve."

Former Nigeria Minister of Digital Economy, Isa Pantamin, also send condolence to di family of di late Ogbeh.

Ben Murray-Bruce

Former Senator wey represent Bayelsa East for di Senate house, Ben Murray-Bruce send prayers to di family of di late politician.

"I dey sad by di passing of Chief Audu Ogbeh, di patriot wey serve Nigeria wit distinction as Minister of Agriculture and Rural Development di National Chairman of di PDP".

Plenti oda Nigerians don also send dia condolence to di late former Nigeria minister while dem also pay tribute to am for im contribution to di kontri.

Audu Ogbeh profile

Audu Innocent Ogbeh be Nigerian farmer and politician wey serve di minister of agriculture and rural development from 2015 to 2019.

E bin also serve as di chairman of di Peoples Democratic Party from 2001 till January 2005.

For di second republic of Nigeria, Ogbeh serve as di Minister of Communications from 1982 to 1983. before e later become Minister of Steel Development. Na wen military coup bring Major-General Muhammadu Buhari to power for 1983, na dat time im tenure end.

Dem born di late former minister for July 1947, for Benue State. E attend King's College for Lagos before e come go study for Ahmadu Bello University, Zaria, including di University of Toulouse, France

E lecture for di Institute of Education, Ahmadu Bello University, Zaria before e head some oda departments for di institution.

For 2001, dem appoint am as di National Chairman of di People's Democratic Party (PDP), e replace Chief Barnabas Gemade. E dey di position until January 2005, wen e bin dey pressed to resign due to im criticism of di way di den President Olusegun Obasanjo handle one crisis for Anambra State.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Skip X post, 5

End of X post, 5