US chess grandmaster Daniel Naroditsky die at di age of 29

Read am in 3 mins

US chess grandmaster and online commentator Daniel Naroditsky don die at di of 29.

Di popular chess player family announce im "unexpected" death for statement wey di club, di Charlotte Chess Center, release on Monday. Dem no tok di cause of death.

"Na wit great sadness we share di unexpected passing of Daniel Naroditsky," di statement tok.

"Daniel na talented chess player, commentator and educator, and a cherished member of di chess community, wey fans and players around di world admire and respect."

Di US and International chess federations don pay tribute to Naroditsky, along wit oda professional players.

Naroditsky first take interest in chess at di age of six, wen im older brother Alan introduce am to di game to help entertain some children for one birthday party.

Im papa Vladimir and multiple coaches soon notice im talents.

"As far as I dey concerned, I was just just dey play games wit my brother," Naroditsky tell di New York Times for one 2022 interview.

E gain international attention in 2007 wen e win di under-12 boys world youth championship for Antalya, Turkey.

In 2010, at di age of 14, e become one of di youngest ever published chess authors wen e write a book wit di title 'Mastering Positional Chess, covering practical skills and technical manoeuvrings'.

For 2013 Naroditsky win di US Junior Championship, wey help am get di title of grandmaster, di international chess federation highest-ranked chess competitor, while e still be teenager.

Naroditsky later graduate from Stanford University and work as a chess coach for Charlotte, North Carolina.

While e still dey compete for high-level events, e transfer im talents to di online chess universe.

Naroditsky YouTube channel gain nearly 500,000 subscribers and im Twitch stream get up to 340,000 followers, wit hundreds of thousands of viewers wey dey watch im regular video tutorials and livestreams against competitors.

Fans praise im talent and passion, casually begin call am 'Danya'.

In 2022 di New York Times name Naroditsky as dia "new chess columnist" and invite am to contribute to many chess puzzles for di newspaper games section.

For im interview wit di New York Times, di young grandmaster tok about how chess take influence im life.

"Even at my level, I still dey discover beautiful tins about di game evri single time I train, teach, play or I be commentator for any tournament," e tok.