You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin Okra water fit give wey Okra soup no fit give?
Okro don become trending topic as pipo don dey discuss about di benefits of dis vegetable inside wata.
Di new tori on di plant wey Nigerians dey take make draw soup na say e dey increase di lubrication for woman private part during sex.
Okro na plant wey dey used world wide including America, and India.
Infact na for India dem dey produce di most amount of okra per year at 6,126,000 tonnes.
As well as where around di world dem dey chop am also don come one new use for am wey be pipo wey dey drink di water.
Di trend bin come from Tiktok and claim say steeping di okro for water wey you put for fridge fit increase libido for both men and women.
Specialist Dietician, Onoja Deborah tell BBC say "as dietician/nutritionist, I no fit endorse di idea of drinking okro water to just improve konji witout scientific evidence to support am.
But as part of balanced diet, okro fit indirectly support libido and sexual health, by say e promote overall wellbeing. For instance, di vitamins nad minerals wey dey inside okro like vitamin C and magnesium dey play roles for hormone production and circulation wey dey important for sexual function."
Ivorian Nutritionist, Marion Ezzedine say e dey beta to chop di plant sha wen e dey raw sake of say, "e go dey more digestible if you cook am but di nutrients dey preserved beta wen di Okro dey raw (most especially di vitamine C wey dey sensitive to heat)."
Wetin be Okro?
Okro na one plant wey dem dey chop im fruit as vegetable, particularly for Africa.
Dis fruiting vegetable dey come for different varieties, depending on di region. Dey get different size, leaves, flowers, fruit and seeds.
Onoja Deborah tok say, "Okro wey dem dey also call ladyfinger, get plenti health benefits. E get low calories and e dey rich in dietary fibre, vitamins C and K, folate, and minerals such as magnesium and manganese. Dis na di nutrient wey dey support digestive health, build immunity, promote healthy skin among odas."
"Okro dey rich in vitamins and minerals. E contain vitamins from di B group, especially B2, B3, B6 and B9, as well as vitamin C. E also rich wit vitamin K," nutritionist Mamadou Seydou Bah, President of di NutriMali association explain.
Okro pods na good source of nutrients and antioxidants like vitamin C, polyphenols, polysaccharides and minerals, according to one 2018 study by Yuan et al.
Antioxidants, as dia name suggest, "fight against wetin dey known as oxidation of cells for di human bodi, wey free radicals dey cause", Bah explain.
How Okro dey affect bodi depending on how dem make am
Nutritionist Mamadou Seydou Bah advise against to boil okra too much to avoid fall for some vitamins. E also advise pipo wey prefer dried okro make dem no leave am too long inside sun.
Howeva, Dietician, Onoja Deborah argue say, di heat from cooking fit make am easy for di bodi to absorb. She say, "To cook okra for soup dey let di nutrients to enta di watr of di soup. Di heat from di cooking dey also break down some of di fibre wey dey inside wey dey make di nutrients dey more accessible for absorption."
But to drink raw okra juice fit get more concentration from wetin dey inside di okro and say "e fit also get more raw plant compounds wey fit dey harder to digest for some pipo."
Onoja Deborah list out wetin fit happun wit consumption of raw okro.
She say, "i you no mwash or prepare your okro wella, or okro wey don spoil fit cause health risks. If dem no wash am well, e fit get harmful bacteria or remaining pesticides fit ey im bodi wey fit lead to foodborne diseases. Also spoilt or overripe okro fit grow mold, wey fit produce harmful toxins for human health."