You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Austria emerge shock Group D winners for Euro 2024
France and Poland don play 1 - 1 draw for dia final group D group stage match for di Signal Iduna park.
Kylian Mbappe wey start im first game since im nose injury tink say im penalty goal go win all three points for Les Bleus.
But Lewandowski gatz oda odeas. Di Polish striker convert im penalty afta im second attempt to draw di game.
Di ref don judge say di French keeper comot im line bifor Lewandowski hit di ball. Na so im take am again to score.
Poland already don comot di tournament but dem play for pride - blocking plenti French attempts from Mbappe, Dembele, Giroud.
Inside di oda game for di group, Austria don hammer Netherlands 3-2.
Di dutch score through Cody Gakpo and Memphis Depay, bifor Schmid equalize on di 59th minute.
But Marcel Sabitzer score di winner for 80 minutes.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wit dia 3-2 win, Austria top di group wit 6 points to qualify for R16 togeda wit France wey now gatz 5 points.
Netherlands finish di group for third place wit 4 points and Poland dey bottom wit one point.
Di Dutch gat chance to qualify to R16 as one of di thrid best-place teams across di groups.
FULLTIME!
Referee don blow whistle for di end of di game. France 1 - 1 Poland.
95" Camavinga don hack down Lewandowski inside di Poland area afta one defender push Mbappe. Di frenchman tink say im deserve freekick but referee no gree.
Austria don beat Netherlands 3-2 for di oda game.
93" More pressure from France. Hernandez pass ball to Mbappe wia di Real Madrid man chip am into di box but Poland clear di ball.
92" France dey drive into di Poland area wit Theo Hernandez but one Poland defender drag am for floor.
91" Mbappe try to fly one shot from inside di box but di keeper catch am afta im deflect.
90' Dem don add 5 minutes to di game - France win corner thru Mbappe. But di corner neva trouble di Polish defense.
89" Poland don win freekick for midfield, dem pass di ball wia dem dey try hold on to possession.
88" France dey try to create sometin for dis last minute but so far notin beta.
86" Randel Kolomuani don enta di game to try and force tins.
85" Giroud gatz one chance to shoot but dem block im ball for corner. Di corner neva trouble Poland.
84" Di last few minutes, France don go quiet.
Drama for di oda game between Netherlands and Austria. Di dutch dey down by 2-3, M. Sabitzer grab di third goal for Austria.
82" Poland don begin dey pile pressure for France. Lewandowski gat one chance wia im strike am wide.
Meanwhile Memphis Depay don equalize for Netherlands against Austria 2-2.
79" Wit dat goal lewandowski don score for four separate Euro tournaments, only Christiano Ronaldo gat di record say im score for five Euros.
78" GOOOOALL! Afta di ref consult di VAR, referee allow Lewankdowski to re-take di penalty. Dis time, im score for di same left hand side,
1-1
77" But Lewandowski protest say di keeper move off im line bifor di penalty.
76" PENALTY MISS! Robert Lewandowski miss di penalty as Maignan save im weak effort.
75" VAR! Referee dey go check di monitor for penalty.
73" Poland tink say dem gatz to win penalty afta Upamecano foul Swiderski inside di box. France go for di oda side to score but Mbappe im shot dey weak
72" CHAAANCE! Lewandowski don strike di ball from distance out of nothing. But di ball goal wide.
67" Swiderski don dey replace Zawleski wia Scoras also enta di game.
66" From di corner, Poland clear dia lines.
65" Joules Kounde beat im man to pass to Griezmann, but di Atletico Madrid forward im strike hit one defender wey e go corner.
64" Camavinga don slip in front of di Poland box as im try to gather one pass. di chance don vanish.
63" Dembele strike one shot off target afta some good team play.
France don dey make three changes - Griezmann, Camavinga and Giroud dey enta di match to replace Rabiot, Kante and Barcola
59" Poland gatz a lot to do to enta dis game, wit 30 minutes to go. Wetin dem fit do?
For di oda game, Austria don take 2-1 lead thru R. Schmid. Wit dat goal Austria go dey second, Netherlands dey third.
55" GOOOAAAAL! Mbappe score di penalty. Im first ever goal for Euro tournament. France lead Poland 1-0.
53" PENALTY! Dembele drive into di box weu Kiwior hack am inside di box. Chance for france to score dia first actual goal for dis tournament.
52" Poland coach Probiersz don chop yellow card for di bench as im disagree wit one decision by di referee.
51" Poland win freekick in front of dia penalty box as Barcola foul im marker.
50" Poland dey struggle to keep di ball.
49" Dis past five minutes na France dey dominate - Mbappe try to bend one shot inside di far corner but im go wide.
48" Poland goalkeeper don make two smart saves inside one minute. one from Kante and di oda from Mbappe.
For di oda match between Netherlands and Austria, di Dutch don equalize thru Cody Gakpo 1-1. Wit dis score, Netherlands don move to di top of di table wit 5 points wia France dey second.
45" Early chance from France. Mbappe don strike wide
Both teams return for di second half. No France player score yet for dis Euros - maybe dis second half go change dat tori.
For Poland, notin to lose, dem just dey play for pride as dem already exit di tournament
Halftime
45" France wit one last chance bifor di referee blow whistle for halftime. Di oda game between Netherlands and Astria also dey halftime. Di dutch dey lose 0 -1.
44" CHAAAANCE! Mbappe beat di offside trap wey im carry di ball enta di box from di far left - di Real Madrid man try to beat di keeper from one tight angle but di keeper dey strong
42" Adrien Rabiot don hack down szymanski, wey di ref show am yellow card.
40" CHANCE! France wan pass di ball into di Poland net. Mbappe almost dey grab goal dia but Poland keeper make fingertip save.
40" Wit 5 minutes to di end of di first half, we go see goal? Na time go show.
38" Lewandowski under pressure from Tchouameni hit one left-foot ball from di French area towards goal but im go wide.
37" From di corner William Saliba don knack di ball wide off di goal.
36" Tchouameni strike one from outside di box afta kante pass one fine ball to di Real Madrid man, but di ball go wide for corner.
35" Poland don dey play some good balls but dia final pass dey lack.
33" CHAAANCE! Lewandowski meet one cross from di left side wia im head am towards goal - di ball beat di French keeper but Lewa say di ball deflect one defender. Referee say goalkick.
32" Zalewski from Poland try to play in im teammate as dem dey try enta di box but France clear am.
31" Mbappe and Barcola try to create sometin for di far left but Barcola show too much of di ball to di Poland defense wia dem clear di ball
30" CHANCE! Moder play one ball thru di French defense to Lewandowski but goalkeeper Maignan comot come catch am.
29" Game don resume for Signal Iduna - France continue from wia dem lerf go di cooling break.
Wit di 1-0 score for di oda game between Netherlands and Austria, France currently dey second wit 5 points wia di Dutch dey third wit 4. Austria at dis point dey lead di group wit 6 points.
27" Foul! Upamecano don foul im marker but bifor di freekick, players don go cooling break.
26" Rabiot, Tchouameni, Hernandez don dey pass di ball among diaserf form ine side of di park, di Poland players no dey see top.
25" Dembele kick di corner but poland keeper Skorupski don claim di ball.
25" France win anoda corner wit Barcola on di left.
22" Poland win corner afta good play - but from di corner, France get counter wit Mbappe but Zalewski don pull im shirt wia im chop yellow card.
19" CHAAAANCE! France break again wit fine chance but Dembele im shot from di right no fit beat di keeper. Di ball fall to Kante close to di penalty spot but im delay wia im pass back to Dembele dey too strong.
18" Di last few minutes na all-France.
14" From di corner, France clear di ball but Lewandowski sit for ground afta one tackle.
13" CHAANCE! Poland gatz one chance to attack di French area but di striker im shot hit Theo Hernandez wia e go for corner.
12" France break on di counter, Mbappe begin di move from midfield wey im pass to Kante, di Al Ittihad player im crossfield ball dey too strong wey di ball comot.
10" CHAAANCE! France dey pepper di Poland area, Dembele gatz so much joy for dia, wia im cross di ball - Theo Hernandez tink say im score with im shot from di left, but di Poland keeper save di ball wey im go corner.
9" Anoda Dembele cross wit im right foot neva dey strong to trouble di keeper.
Netherlands don dey 1- 0 down to Austria for di oda game wey dey happen. D. Malen score own goal.
7" Dembele carry ball enta di box but im right foot shot no trouble di backline.
6" Di battle inside midfield don begin to shape up well well, Moder from Poland dey keep eye on Kante.
5" Poland dey try enta di French area wit Zielinski hitting one shot from outside di box but keeper Maignan don save am.
4" Les Bleus gat two corners in quick succession but las las di ball neva trouble Poland.
4" France win corner from some good play by Barcola, di PSG man try to cutback di ball into di area but Poland clear am.
3" Early freekick for France afta one tackle on Kounde; Les Bleus don take am quickly.
2" France dey pass pass di ball around di Poland box wit Kante, Dembele, Mbappe - but Poland don sit back dey protect dia goal area.
1" Mbappe don get early touch of di ball wia di crowd dey chant im name as both teams try to settle for dis one
Poland dey wear dia red jersey as France carry dia traditional blue shirt
1" Referee don blow whistle for match to start
Both teams alreadi comot for park - wia dem don dey sing national anthems.
Greetings pipo. Dis na di live commentary for di game between France and Poland.
Lineups
France XI: Maignan (GK); Kounde, Upamecano, Saliba, T. Hernandez, Tchouameni, Kante, Rabiot, Dembele, Mbappe ©, Barcola
Poland XI: Szczesny (GK); Bednarek, Dawidowicz, Kiwior, Frankowski, Zielinski, Moder, Zalewski, Szymanski, Lewandowski, Urbanski