Guinea military ruler sack 60 soldiers afta jailbreak involve Moussa Dadis Camara

Wia dis foto come from, Getty Images
Authorities for Guinea say nine pipo bin die during di 4 November jailbreak while six odas get gun injuries.
Dis dey come afta over 60 sojas and prison officers chop sack for di kontri sake of Saturday jailbreak of former junta leader Moussa Dadis Camara and two odas.
For one provisional assessment report, di Prosecutor General Yamoussa Conte say di nine bodies dey for three morgues.
Four of dem be officers of di defense and security forces, while three wey dem neva sabi who dem be, believe to dey among di attackers wey die "during exchange of fire" as dem enta Samatran district.
Junta leader Col Mamady Doumbouya bin tok for one decree on Sunday say dem sack di military and prison officers for “breach of employment and misconduct”.
Di sacked military officers include fugitive Claude Pivi, Moussa Thiegboro Camara and Blaise Goumou, Doumbouya tok.
Manhunt dey go on for Pivi, one former minister of presidential security for Dadis Camara junta, wey still dey on di run.
Officials bin recapture Me Camara and return am to prison few hours afta e free from im cell by gunmen wey dem describe as “heavily armed commandos” for early mor-mor Saturday.
End of Di one wey oda users dey read well well
One army tok-tok pesin say di prison break na attempt to "sabotage" goment reforms and swear say dem really commit to di ruling junta.
Justice Minister Alphonse Charles Wright don pledge to go on wit di trial of Camara for im alleged role for di killing of 150 pipo and di rape of over 100 women for 2009 during one crackdown on anti-goment demonstrators for Conakry.
Guinea na one of eight kontries for West and Central Africa wey military dey rule for di last three years.
For di fourth day of November 2023, armed men bin break enta prison wey dey hold Moussa Dadis Camara around 5:00 am and dem release di former head of state and three odas.
Oga Conte dey call for additional investigations and public action against former junta leader Moussa Dadis Camara, Colonel Moussa Thiegboro Camara, Colonel Blaise Gomou, Colonel Claude Pivi and others.
Charges wey dey against dem na "acts of assassination" against agents of di defense and security forces for di exercise dia sovereign function, "involuntary manslaughter, abandonment of post, violation of instructions and complicity."
State Prosecutor Conte also note say "serious signs say dem abandon dia post and violate instructions" suppose dey noted.
Di Human Rights Watch Associate International Justice Director, Elise Keppler, urge authorities for Guinea to provide maximum security for detention centres.
According to Keppler, di security measure na ways to make sure say those wey dey accused of gross rights abuses go dey accountable.
Oga Keppler also show worry about Saturday incident and note say di landmark trial for Guinea stadium massacre and im progress how dem make sure victims get justice and pierce long-standing impunity for abuses for Guinea dey too important to stop.”














