Guinea former ruler wey armed men comot from prison don return to jail

Wia dis foto come from, AFP
Guinea former military ruler, Moussa Dadis Camara, don return back to jail afta armed men comot am from prison, according to im lawyer.
Di group bin break into one jail for di capital, Conakry, early on Saturday morning – and dem carry Capt Camara plus three odas.
Di pipo wey dem take currently dey on trial for dia alleged roles for di deaths of more dan 150 pipo for inside one 2009 protest.
Apart from Capt Camara, authorities don see two oda prisoners.
E neva clear if dis na case of kidnapping or if na dia supporters free.
Capt Camara lawyer bin earlier tell BBC say dem take di former leader against im will, and say e no go ever try to escape prison, as e get confidence for di Guinean judicial system.
Di kontri close dia borders as authorities hunt for am and di odas wey di armed men carry.
Na Guinea Justice Minister, Charles Alphonse Wright, announce dia escape on local radio.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say di armed men break enta prison wey dey hold Moussa Dadis Camara around 5:00 am and dem release di former head of state.
"We go find dem. And hold those wey dey responsible accountable".
Di former head of state currently dey on trial for di killing of 156 opposition supporters for one rally for 2009.
Authorities tok say dem don see one of those wey escape, but oga Camara and two odas still dey at large.
Di fugitives currently dey on trial ova di kontri worst massacre wey happun for 2009.
Among odas wey dem report say don escape na Col Claude Pivi, one former goment minister wey chop accuse say e also get hand for di murder of pipo for Conakry stadium on 28 September 2009.
Details of wetin happun still dey comot from di coastal capital, Conakry, however multiple eyewitnesses, tok say dem begin hear heavy gunshots for early mor-mor and armed men don block access to di city centre.
“Plenty gunshots begin dey blast for night around dat kain 4:00am and again for dis morning, we dey hear gunshots,” Aminata Soumah, one Kaloum resident tell Reuters for fone.

Wia dis foto come from, AFP
Military vehicles also plenty for the streets of di Guinean capital.
At least 157 pipo die wen sojas attack pipo wey dey protest against military rule. Dem rape plenty women too.
Col Pivi, Capt Camara and nine oda former officials wey chop accuse ova di massacre don deny di allegations against dem.
Capt Camara dey charged accuse say na im command di sojas wey carry out di alleged crimes.
E seize power for 2008 wen long-time President Lansana Conté die, but dem comot am by coup and e run comot di kontri e no tey afta di Conakry killings and afta one assassination attempt.
Di 59-year-old bin dey live for Burkina Faso before e go back Guinea for September 2022 to face justice.
Guinea currently dey under military rule, one of several former French colonies for West and Central Africa wey don stage coups in di past three years.
Di most recent bin happun for 2021, wen former French soja, Col Mamady Doumbouya bin lead one rebellion against President Alpha Condé. Dem later swear-in Col Doumbouya as president.
We still dey chook eye for dis tori.












