Ways to use TikTok and avoid ban

Social media influencer Saidaboj wey her real name na Sarah Idaji Ojone don allegedly chop suspension from social media platform Tiktok.

Saidaboj suspension happun afta one video wia she tok tins wey many pipo see as offensive trend online.

Di popular skit maker gbege start afta she tok tins wey encourage young females to engage for relationship sake of money for one podcast Honest Bunch podcast.

During di programme Saidaboj futher tok plenti sexual related tins wey many pipo dey comment online say dey fit mislead young pipo.

Sake of dat, plenti pipo bin report Saida Boj TikTok account and di video sharing platform no waste time to suspend her account wey get over 1.3 million followers for dia.

TikTok don begin face ban for some kontris for some years now sake of violent content on di platform becos of regulation on some kain contents.

Di social media platform don make am strict policy to remove violent content.

TikTok get one ogbonge community guidelines wey dey set rules for wetin dey allowed on di platform.

Dem dey use tools and technology to sabi and remove harmful content and behaviour wey go against dia community guidelines.

According to TikTok na dis tools dey help advance di safety of dia community and maintain di integrity of di platform.

Also, TikTok dey use pipo (reports) to sabi any pesin wey don act against dia community rules.

Wetin dis one mean be say di video sharing platform dey use both automated and human evaluation to know who don commit offense for dia platform.

TikTok add say if dem find any violations and remove dat content, dem go notify di account owner.

Wetin fit cause ban for your TikTok account and how to avoid am?

TikTok fit permanently ban your accounts if dem sabi di violations of dia community guidelines and terms of service, wey include:

  • You no meet di minimum age or oda requirements as e show for dia terms of service. Wetin you fit do na say make you no cut corners - just to meet di right age condition.
  • Your account dey impersonate anoda pesin or entity for cunny-cunny way.
  • You get serious violation on your account
  • You dey post, promote, or arrange youth exploitation or child sexual abuse material (CSAM).
  • Promote or dey threaten violence.
  • Post or dey promote content wey dey tok about non-consensual sex acts like rape or molestation
  • Post content wey dey represent human trafficking.
  • Post content wey dey represent real-world torture.
  • Create or use anoda TikTok account to intentionally avoid restrictions or permanent ban wey di platform sama anoda account.
  • Your account don reach di amount of strike for multiple violations wey dey within one policy or feature.
  • You dey violate TikTok intellectual property plenti times.
  • Koko be say, if your account enta permanent ban for Tiktok, you go need wait till afta di ban bifor you fit open anoda account.

How you fit protect your account from TikTok ban

No share Violent Content

You fit protect your TikTok account if you no share violent content. TikTok get algorithms wey dey detect anytin wit blood, guns and oda graphic content wey fit land you ban. Make we no tok of wen you share am.

No ever threaten users

Even though many pipo dey like find trouble online, no ever try threaten dem so your account no go chop ban from TikTok.

No promote self-harm

TikTok no make very strict policies wey dey deal wit content wey promote or glorify bad tins like self-harm, suicide, eating disorder or stunt wey fit cause injury.

No ever share content wey dey promote mago-mago activities

To post or stream videos wey dey show and encourage tiff-tiff activities like fake trade, drug abuse, or to break law fit cause you your account.

No go near spam behavior and content wey no dey good

Di first tin wey fit make you get TikTok shadowban na if you dey behave like spammer.

Some pipo like to dey encourage odas to follow dem so dem go follow back.

Na dis kind act wey TikTok reason as spam if you don do am many times.

Wetin you fit do na to keep your regular post to less dan 100, and no follow more dan 50 pipo inside one day to avoid dis problem.

If you don reason all of dis, if you put hate speech, fake news, violence, nudity, copyright music, and drugs for your videos, e fit lead to shadow ban.

But If you no avoid dis type of content, your account go dey banned permanently.