APC tok why dem omit Osinbajo name from presidential campaign council list

Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo
Nigeria Vice President Yemi Osinbajo dey miss for di list of Presidential campaign council nominees wey di All Progressives Congress (APC) release on Saturday.
Secretary to di goment of di Federation Boss Mustapha, former Secretary to di Govment of di Federation, Babachir Lawal; former Speaker of di House of Representatives, Yakubu Dogara; former Minister of State for Education, Chukwuemeka Nwajiuba, and some odas too dia names no dey di list.
Osinbajo and Nwajiuba bin contest di presidential primary of di ruling party with former Lagos state Govnor Bola Tinubu. Tinubu win.
Tinubu announcement of former govnor of Borno State, Kashim Shettima, as im running mate, na sometin wey cause controversy.
Tori be say some APC top pipo like Dogara and Lawal as well as di Christian Association of Nigeria bin frown at dat decision.
Now, dia names wey no dey di list of 422 pipo don make pipo dey tok upandan ontop social media.
But tok-tok pesin for di Tinubu and Shettima presidential campaign organisation, Festus Keyamo for statement don come out to say na President Muhammadu Buhari direct dem to "specifically " remove dia names.
E explain say di decision of President Buhari na to give dem chance to concentrate on governance and administration of goment.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who and who dey di list?
Di secretary of Nigeria ruling All Progresives Congress (APC) don tell all 422 pipo wey dem select for di Presidential Campaign Council to come kolect dia letters on Monday 26 September 2022, for di Tinibu Shettima National Presidential Campaign office for Abuja Nigeria.
Di All Progressives Congress release a list of 422 nominees for di Presidential Campaign Council ahead of di 2023 Elections.
Na President Muhammadu Buhari be di Chairman of di campaign Council, Asiwaju Ahmed Bola Tinubu na di Deputy Chairman.
Abdullahi Adamu na Deputy 2, while Kashim Shettima na Vice Chairman.
Some oda ogbonge party members wey dey di list include
Former APC Chairman Adams Oshiomole na di Deputy Director General, Operations.
Sen. Godswill Akpabio , David Umahi and Badaru Abubakar.

Wia dis foto come from, APC Facebook
Oda big names wey dey di list
Some big party members dey under di Zonal Coordinators category, most of di incumbent govnors dey dis group.
Sen. Ben Ayade wey be govnor of Cross Rivers State, Rotimi Akeredolu of Ondo State, Hope Uzodinma of Imo State and Abubaka Sani Bello of Niger State.
Presidential candidate aspirant Chibuike Rotimi Amaechi, and some former Govnors Ali Modu Sheriff, Gbenga Daniel, George Akume , Murtala Nyako, Isa Yuguda, Rochas Okorocha and odas na members of di Campaign Council.
Former Acting Director of NDDC, Ibim Semenitari wey don tender her resignation letter from di party few months ago also dey di list for di media department.
No be only politicians dey di list too, entertainers like Zack Orji, Jide Kosoko, Saheed Balogun, Bimbo Akintola and odas dey di list.
See full list below

Wia dis foto come from, APC Facebook

Wia dis foto come from, APC Facebook

Wia dis foto come from, APC Facebook
PDP Presidential Campaign list
Di main opposition party for Nigeria, di Peoples Democratic Party, PDP bin release dia own Presidential Campaign Organization list on 16 September, 2022.
According to di list, Akwa Ibom State Govnor Udom Emmanuel na Chairman.
Bala Abdulkadir Mohammed and Oyo State Govnor Seyi Makinde na Vice Chairman for di northern and southern regions of di kontri.
Former Presidential Aspirant Aminu Tambuwal wey step down for Atiku during di Presidential primaries na Director General of di campaign organization.
Former Cross River State Govnor Liyel Imoke and Raymond Dokpesi dey di list.
But twist dey wen Rivers state Govnor Nyesom Wike and some of im team members pull out of di PDP Presidential campaign council.
Na sake of say dem want di current chairman of di party, Iyorchia Ayu to resign and give way for an acting chairman from southern Nigeria.
Na on Wednesday 21 September, 2022 afta one meeting for Port Harcourt, di Rivers State capital dem make di announcement.
Di team members include Governor of Oyo State, Seyi Makinde, former Governors of Cross River and Ekiti states Donald Duke and Ayo Fayose among many odas.
Wetin be di work of campaign council
Di work of di Presidential campaign Council or organization na to make sure say dia candidates emerge as winner of di 2023 General Elections.
Dia duties na to serve in dia areas of strength and capacities for dia respective zones and areas to ensure so campaign go smoothly and dem win di election.
For 2015 Chibuike Rotimi Amaechi na di Director General of President Muhammadu Buhari campaign council and e make sure say Buhari win di election.










