Super Eagles beat Lesotho 2:1 but e dey enough to qualify dem?

Nigeria midfielder William Troost-Ekong (C) celebrate afta e score im team first goal from penalty shot during di FIFA World Cup 2026 Africa qualifiers group C match between Lesotho and Nigeria for di Peter Mokaba Stadium for Polokwane on October 10, 2025.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Nigeria Super Eagles don move one step closer to 2026 FIFA World Cup qualification afta dem beat Lesotho 2-1 on Friday for inside one match wey fit prove decisive for Nigeria campaign.

Troost Ekong bin give Nigeria di perfect start for di 55th minute as e convert one penalty into goal afta one handball for di Lesotho box.

Akor Adams later double di advantage wit one ogbonge finish for di 80th minute, wey put Nigeria on top.

Lesotho respond for di 83rd minute wit one goal from Kalake, but di Eagles secure di crucial three points.

However, Benin Republic score dia own match, wey mean say Nigeria go remain behind on points and goal difference in Group C.

Nigeria still dey third for di standings, wit three points behind group leaders Benin and one shy of South Africa, wey draw 0-0 wit Zimbabwe.

Nigeria and Lesotho face each oda for di Fifa 2026 World Cup qualifying match for di New Peter Mokaba Stadium in Polokwane, South Africa,

Di West African kontri dey hope say dem go fit qualify for dis World Cup afta dem miss out from di 2022 edition.

For dia first match Nigeria come from behind to play 1-1 draw wit Lesotho.

Lesotho shock di three time African champions afta dem take di lead through Motlomelo Mkhwanazifor goal inside 56 minutes for di Godswill Akpabio stadium for Uyo.

Super Eagles struggle to break down di Crocodiles wey defend well through out di match.

However, Nigeria need to get all di three points for dis match and even dia next match den rely on fate.

For Nigeria to qualify, di Super Eagles need to beat Benin Republic with at least 3-0 for di last match and pray say South Africa go lose dia match against Rwanda on Tuesday 14 October.