You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Musk $1m-a-day giveaway to swing states voters 'deeply concerning'
- Author, Tom Bennett
- Role, BBC News
- Author, Kayla Epstein
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Tech billionaire Elon Musk don tok say e go do give away $1m (£766,000) per day to registered voter for key swing states until di US presidential election on 5 November.
Na from those wey sign one pro-US Constitution petition by Oga Musk campaign group AmericaPAC wey dem go randomly choose winner, wey e go set up to support Republican nominee Donald Trump bid to return to di White House.
Dem bin give away di first lottery-style to one surprised attendee for one town hall event for Pennsylvania on Saturday night. Dem bin hand out anoda cheque on Sunday.
Pennsylvania Governor Josh Shapiro, one Democrat wey dey support Kamala Harris, bin call Oga Musk strategy "deeply concerning."
Shapiro bin tell NBC News Meet di Press say law enforcement suppose potentially look di payments.
Di contest dey open to voters for Pennsylvania, Georgia, Nevada, Arizona, Michigan, Wisconsin and North Carolina, all key battleground states wey go ultimately decide di White House election.
Election law expert Rick Hasen bin write on im personal Election Law Blog say e believe say Oga Musk offer dey "clearly illegal".
Federal law states say anyone wey "pay or offer to pay or accepts payment either for registration to vote or for voting" face potential $10,000 fine or five-year prison sentence.
End of Di one wey oda users dey read well well
Though Oga Musk dey technically ask voters to sign one form, Oga Hasen bin question di reason behind di strategy.
"Who fit sign di petitions? Only register voters swing states, wey be wetin make am illegal," oga Hasen tok, one professor for di University of California, Los Angeles (UCLA) law school.
Those wey sign di petition - wey pledge to support free speech and gun rights - must submit dia contact details, wey fit allow AmericaPAC to contact dem about dia vote.
Both Oga Musk and AmericaPAC don dey approach for comment.
Campaigns and political action committees rely on tactics like petition sign, survey requests, or merchandise wey dem buy to build massive databases of voter informate. Dat data fit den dey used more accurately to target voters, or raise funds from supporters wey already dey onboard.
For Pennsylvania, Oga Musk dey give voters $100 to sign di petition, plus anoda $100 for each pesin dem refer wey sign. Voters for oda battleground states dey get $47 per referral.
But di strategy fit dey covered by one loophole under US election law sake of say no-one dey directly paid to vote - despite say dem introduce money into one process wey fit identify likely Trump voters.
For di US, e dey illegal to provide payments to get pipo to vote - no be only for one kind candidate, but to simply cast ballot.
Di rule bin prompt icecream-maker Ben & Jerry to give im product free to everyone on election day for 2008, as dem don initially plan to limit am just to those wit one "I vote" sticker.
While e dey campaign on Sunday, Trump dey asked about Oga Musk's giveaway.
"I neva follow dat," e bin tok, come add say e dey speak to Oga Musk often and e be "friend".
Di founder of SpaceX and Tesla and owner of X, formerly Twitter, don show face as as one key Trump supporter.
Oga Musk launch AmericaPAC for July wit di aim to support di former president campaign.
E don so far donate $75m (£57.5m) to di group, wey don quickly become one central player for Trump election bid.
Di Trump campaign highly rely on outside groups like AmericaPAC to canvas voters.
For statement on di group website read say: “AmericaPAC dey created to support dis key values: Secure Borders, Safe Cities, Sensible spending, Fair Justice System, Free Speech, Right to Self-Protection.”
Oga Musk tok say e want get “over one million, maybe two million, voters for di battleground states to sign di petition to support di First and Second Amendment”.
“I think say [e] send one key message to our elected politicians,” e add.
Oga Musk na currently di world richest man, wit estimated net worth of $248bn (£191bn), according to US business magazine Forbes.