How Nigerians and South Africans dey take demsefs catch cruise by ordering and cancelling online taxis

Read am in 3 mins

Nigerians and South Africans online fight-fight don enta anoda dimension as citizens of both kontris dey use demsefs catch cruise by ordering Bolt and Uber online and cancelling di ride.

South Africans go dey dia house and begin order taxis for Nigeria, and Nigerians begin retaliate by ordering South African rides from di comfort of dia homes for Nigeria.

Once di driver don accept di ride and begin drive to di location or don already dey for di location, pesin wey order di ride go cancel am.

Nigerians on X, formerly Twitter, dey mobilise fellow citizens to go on di e-hailing apps and book rides in South Africa to show di power of numbers.

Some Nigerians on X dey mock South Africans for starting di taxi ordering ‘war’ wey dem fit no win sake of say Nigerians get more numbers dan dem.

While some pipo see di trend as harmless fun, odas don point out say na di drivers for both Nigeria and South Africa dey bear di brunt of di prank, as dem dey waste time, fuel and energy responding to ride request wey go dey eventually cancelled.

Bolt react

Ride-hailing app Bolt don block some accounts wey dey request fake rides and cancelling dem afta driver accept.

Di kontri don also restrict intercountry ride requests to stop di cruise wey Nigerians and South Africans dey use demsefs catch.

“We understand di impact dis situation don get on our driver-partners for Nigeria and South Africa. We dey committed to ensure a safe, reliable, and secure experience for all members of our community,” Bolt kontri manager Yahaya Mohammed tok.

South Africa and Nigeria rivalry

Di Nigeria and South Africa rivalry na one of Africa most prominent rivalries. Dis rivalry dey evident in areas like sports, politics, and entertainment.

For football, both nations get fierce rivalry. Encounters between Nigeria Super Eagles and South Africa Bafana Bafana dey often dey hot and draw ogbonge attention across Africa. Each team see diasef as a regional powerhouse, and dis dey lead to heated matches and debates among fans.

For entertainment, di rise of Afrobeats for Nigeria and di influence of South African genres like Amapiano don fuel debates ova dominance in African music. Di global success of Nigerian artists don often spark discussions, wit South Africans showcasing dia vibrant local scene in response.

Politically, both kontris have don vie for leadership for Africa, whether for economic influence, regional diplomacy, or roles for pan-African organisations. Di xenophobic attacks for South Africa wey dey target Nigerians don deepen tensions and straine diplomatic ties and public sentiment.

Despite dis rivalry, Nigeria and South Africa remain key partners in driving growth across Africa.