Nigeria don enta part of 34 kontris wey US ask visa bonds from, wetin be visa bonds?

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerians wey dey apply for US B1/B2 visas go post bonds of up to $15,000.
Nigeria na one of 24 African kontris out of di 38 kontris wey di state department bin release on Tuesday.
Di kontris include:
- Algeria (January 21, 2026)
- Angola (January 21, 2026)
- Antigua and Barbuda (January 21, 2026)
- Bangladesh (January 21, 2026)
- Benin (January 21, 2026)
- Bhutan (January 1, 2026)
- Botswana (January 1, 2026)
- Burundi (January 21, 2026)
- Cabo Verde (January 21, 2026)
- Central African Republic (January 1, 2026)
- Cote D'Ivorie (January 21, 2026)
- Cuba (January 21, 2026)
- Djibouti (January 21, 2026)
- Dominica (January 21, 2026)
- Fiji (January 21, 2026)
- Gabon (January 21, 2026)
- The Gambia (October 11, 2025)
- Guinea (January 1, 2026)
- Guinea Bissau (January 1, 2026)
- Kyrgyzstan (January 21, 2026)
- Malawi (August 20, 2025)
- Mauritania (October 23, 2025)
- Namibia (January 1, 2026)
- Nepal (January 21, 2026)
- Nigeria (January 21, 2026)
- Sao Tome and Principe (October 23, 2025)
- Senegal (January 21, 2026)
- Tajikistan (January 21, 2026)
- Tanzania (October 23, 2025)
- Togo (January 21, 2026)
- Tonga (January 21, 2026)
- Turkmenistan (January 1, 2026)
- Tuvalu (January 21, 2026)
- Uganda (January 21, 2026)
- Vanuatu (January 21, 2026)
- Venezuela (January 21, 2026)
- Zambia (August 20, 2025)
- Zimbabwe (January 21, 2026)
Di measures get different different dates as implementation go start from 21 January.
Some kontris visa bonds don alreadi start like Malawi and Zambia wey start for 20 August, 2025, The Gambia wey start for 11 October, meanwhile Tanzania, Sao Tome and Principe, and Mauritania visa bonds bin start for 23 October while Mamibia start for 1 January.
Di rest go start like Nigeria for 21 January, 2026.
Wetin be visa Bonds
Visa bonds na financial guarnatees wey di US state department now dey require from some foreign nationals wey dey come from high risk kontris wey dey apply for B1/B2 visas wey be di visas for either business or tourism.
Di state department notice tok say, "any citizen or national wey dey travel wit passport wey one of dis kontris, but fit normally apply for B1/B2 visa must to post bond for $5,000, $10,000, or $15,000. Na for visa interview time dem go sabi which amount dem go post."
Dem also add say, "bond no mean say you must get di visao. If pesin pay fees witout say na consular officer direct you, di money don go be dat".
Dem also torchlight specific airports wia di affected visa holders fit use take enta di US. Dem be three wey include Boston Logan, John F. Kennedy in New York, and Washington Dulles in Virginia.
But di bonds dey refundable. According to di state department, di bonds go only dey refunded on three conditions.
One, wen di Department of Homeland Security (DHS) don record say di visa holder don comot di US on or bifor di time wey dem dey allowed to stay.
Two, wen di applicant no travel enta di US bifor dia visa expire finish and three, if di traveller apply and dem deny am make e no fit enta for di US port of entry.
Dis mata dey come about a week afta partial US travel restrictions for Nigeria start.
For dat travel restrictions, Nigeria dey part of 15 kontris most of dem African kontris wey bin dey placed under partial travel suspensions by di US goment from December 16. Some of di kontris na Angola, Antigua and Barbuda, Benin, Côte d'Ivoire, Dominica, Gabon, and The Gambia.
Di reason di US bin reason Nigeria for di partial restrictions na wetin dem call di free operation of radical Islamic terrorist groups like Boko Haram and di Islamic State for some parts of di kontri, say e dey create "substantial screening and vetting difficulties".
Dem also add say Nigerians dey overstay dia B-1/B-2 visa by 5.56% and 11.9% for di F, M, and J visas.









