Maps wey show Ukraine war with Russia

- Author, Visual Journalism Team
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
Fighting don dey happun for Ukraine since Russia launch full-scale invasion for February 2022. Russian forces, for recent months, don dey make small gains but Ukraine forces don stage one counter-offensive as dem enta Russia border from di north-east.
Dis na reminder of recent ogbonge events and di situation for ground for Ukraine.
Ukraine send troops enta Russia
Ukraine troops launch surprise attack across di border for early August enter up to 30km inside di Russian region of Kursk.
Russian goment don comot almost 200,000 pipo from border districts like Belovsky and Krasnaya Yaruga. Vladmir Puin tok say di offensive na "major provocation".
Afta one week, Ukraine top commander claim say dem dey control 1,000 sq km of Russian territory even though analysts tok say di true scale dey smaller, and di regions of Kursk and Belgorod don declare state of emergency.

Di acting govnor for Kursk region say 28 communities don fall for Ukraine forces but Ukraine president later say na 74.
Di counter-offensive na something wey dem see partially as an attempt to try to make Russia carry units from eastern Ukraine and so dat di Ukraine defences for dia fit rest. Anoda part na way to improve Ukraine chance for peace settlement.
Russia attack for north of Kharkiv
For di beginning of May 2024, Russian forces cross di international border enta di north of Ukraine second biggest city wey be Kharkiv. Dem seize plenti villages and make thousands of civilians to run comot house.
Russia main offensive don focus on di Donetsk region for long but dis na one of di most ogbonge ground assault since di war start and e don cause stress for Ukraine frontline defences.

Di Russian push bin happun for di end of one four-month period wen di US bin no dey supply weapons give Ukraine as di US Congress bin dey stalemate.
Dem fix di issue by di end of April wen di US pass $61bn aid package to give di Ukraine military missiles, artillery and air-defence systems.
Even though di city of Kharkiv don face repeat attacks wit glide bombs wey Russian warplanes drop, e no dey wia di range of Russian artillery fit reach.
Russia dey move forward for di east
Di attack for di north of Kharkiv dey far small from di main front line for di east wia Russia don continue dia offensive operations and don dey move forward small-small since October 2023.
Eastern Ukraine na contested territory since 2014 wen Russian backed fighters bin seize plenti parts of di eastern Donetsk and Luhansk regions.

Russia biggest advantage na manpower and dem don show a willingness to throw soldiers for Ukrainian positions to gain a few meters at times
Dem kill around 1,200 Russian sojas or injured dem everiday for May and June wey be di highest rate since di beginning of di war, according to Western officials.
Meanwhile, Ukraine don reduce di minimum age for conscription from 27 to 25 to help relive dia exhausted front-line troops.
Russia don find success for di town of Avdiivka wia Ukrainian troops comot for February afta dem don dey fight for months.
Na di biggest change to di ova 1,000km long frontline since May 2023 wen Russian troops seize di nearby city of Bakhmut.

If to say Ukraine counter-offensive bin dey successful, Avdiivka for be gateway wey Ukraine for take enta di Russian controlled city of Donetsk, but dat chance don pass.
Almost all di pre-war members of di town wey pass 300,000 pipo don run comot and town don almost completely dey destroyed.
Russia now dey in control of wetin remain and dey push west wit dia eye for di Ukraine held towns of Pokrovsk and Chasiv Yar, wey dey high ground about 10km west of Bakhmut.
Areas around Bakhmut don face some of di heaviest fighting for di war.
Even though Ukraine bin gain ground for di surrounding areas, Russian forces don still make advances around di city.

Two and half years of fighting
Russia invasion bin start wit dozens of missiles strikes for cities all ova Ukraine bifor morning for 24 February 2022.
Russian ground troops sharp-sharp enta and within few weeks, don control large areas of Ukraine and move for di suburbs of Kyiv.
Russian forces bin dey bombard Kharkiv and dem don take territory for di east and south to reach Kherson and surround di port city for Mariupol.

But dem don jam very strong Ukraine resistance almost evriwia and face serious logical problems as Russian troops bin dey face shortage of food, water and weapons.
Ukraine forces bin also sharp-sharp deploy Western supplied arms like di Nlaw anti-tank system, wey bin prove effective against di Russian advance.
By October 2022, di picture bin change and as dem fail to take Kyiv, Russia comot completely for di north. Di next month, Ukraine forces recapture di southern city for Kherson.
Since den, di war don mostly dey for di east of Ukraine wit Russian forces slowly gaining more ground ova many months as dem lose at least 50,000 troops and probably plenti more.
About dis maps dem
To show which parts of Ukraine dey under control by Russian troops, we dey use daily assessment wey di Institude for di Study of War and di American Enterprise Institute Critical Threats Project. To show key areas wia advances dey happun, we dey also use updates from di UK Ministry of Defence and BBC research.
Di situation for Ukraine dey move fast and e dey likely say some of di changes no go dey dis maps.









