Court grant bail to Abia lawmaker Alex Ikwechegh wey allegedly assault Bolt driver

Alex Ikwechegh

Wia dis foto come from, Alex Ikwechegh/Facebook

Read am in 4 mins

Di magistrate court for Abuja don grant bail to di House of Representative member, Alex Ikwechegh, wey show for video wia e dey allegedly assault one Bolt driver for Abuja.

According to di court, dem charge am wit offence wey concern threats, assaults and abuse of public office.

Dis arraignment for court bin follow petition wey dem use drag di lawmaker go court afta di assault incident for Nigeria capital wey involve Bolt driver, Stephen Abuwatseya wey come deliver items to im house.

For informate wey reach us, di lawmaker appear today for Kuje Magistrate Court.wia dem grant am bail to di tune of 500,000 naira.

Dis arraignment dey come afta di police promise to investigate di case.

Police take action on Abia Lawmaker

A Nigerian lawmaker Alex Ikwechegh Mascot

Wia dis foto come from, Alex Ikwechegh Mascot/Facebook

Di Nigeria Police alreadi begin to dey prosecute di Abia lawmaker.

According to informate wey di police tok-tok pesin Olumuyiwa Adejobi bin make public through a statement on Wednesday 30 October, dem don conclude investgation into di case of di lawmaker.

"Di Nigeria Police Force Special Investigation Unit and the Legal Section don conclude investigations into di case and today arraign Hon. Alexander Mascot Ikwechegh on di charges of 'Abuse of Office, Criminal Intimidation and Criminal Force and Assault," di statement tok.

Di police say di action of di ;lawmaker dey against Sections 397 (b) and 265 of di Penal Code Act.

Na on Sunday di mata bin happun wia Oga Alex Ikwechegh, a House of representative member bin get gbege wit Bolt driver, Stephen Abuwatseya wey come deliver goods to am.

According to di tok tok pesin, di IGP don order make dem do proper investigation to ensure say dem serve justice and promote human dignity for Nigeria.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Wetin happun bifor

Wen di mata bin happun and di video go viral for social media, Abuja Police Command bin arrest lawmaker for assaulting di driver.

Di Abuja police tok-tok pesin, Josephine Adeh, confam say Alex Mascot Ikwechegh bin dey police custody and dem dey kwesion am.

Police say dia investigation show say oga Ikwechegh “physically assault” di bolt driver wey deliver package to Oga Ikwechegh.

“Di FCT Police Command express concern ova Ikwechegh dismissive attitude towards di office of the Inspector General of Police following di incident," di statement tok.

“Currently, di suspect dey di Maitama Police Station undergoing questioning.”

How di mata take start

On Sunday, Bolt driver, Stephen Abuwatseya allege say Oga Alex Ikwechegh, a House of representative member assault am and tear im cloth wen e go deliver package to am for im house in Abuja.

Inside one video wey dey spread for social media, di bolt driver request for im money but di lawmaker refuse say im no go pay di driver becos of disrespect.

Oga Ikwechegh insist say e no go pay di driver, and as im dey express im anger e call di business owner to report di delivery man while making threatens say e go "make dis man disappear in di whole Nigeria and notin go happun."

Di lawmaker and driver begin exchange words ova di matta and di lawmaker waka towards di driver, wit sound of phisical attack.

Oga Abuwatseya allege say di lawmaker slap am three times for di video " Are you slapping me sir?"

"You dey look me and tink say you fit beat me? Who do hell you tink you dey follow tok. You sabi who I be?"

Inside di second video, di driver allege say di lawmaker tear im cloth comot from im body "As una dey see I no wear cloth, e don tear my cloth e slap me three times........"

Di lawmaker threaten am make im go report to di police "Call di Inspector General of Police. Call am, make im come here. Record me very well. You come my house, you disrespect me."

Di driver respond say im no disrespect am, make di lawmaker pay am im money so e go fit comot.

Di lawmaker neva tok anytin on di mata since di video come out.

Who be Alex Ikwechegh?

Foto of Alex Ikwechegh

Wia dis foto come from, @alexmascot05/Instagram

Alex Ikwechegh begin im poltical career for 2019 as chairman for Aba North local goment in Abia state at di age of 28. Im kontinu as im seek election as representative for di North and South Federal Constituency.

E hold bachelor degree from University of Calabar wia e graduate wit degree in business management.