Watch how Pope Francis burial take happen for Rome as politicians, royalty and 400,000 mourners show face
Dem don bury Pope Francis for Santa Maria Maggiore basilica afta im funeral for di Vatican.
Dozens of leaders and dignitaries - including Donald Trump, Volodymyr Zelensky, and Prince William - bin join thousands of mourners for St Peter's Square.
At least 400,000 pipo bin gada for di Vatican City for Pope Francis funeral and line di streets to watch as dem take im coffin to di Santa Maria Maggiore church for burial, according to Italy interior minister.
"We estimate not fewer dan 400,000 pipo between dose present for St Peter's Square and dose along di route," Matteo Piantedosi tell Italian news programme TG5.
Trump, Prince William, and oda leaders pay dia respects to Pope Francis coffin inside di basilica bifor di service begin.
Di funeral bring togeda some of di world most powerful pipo wit some of di most marginalised.
Who lead di funeral service?

Wia dis foto come from, Reuters
Na di dean of di College of Cardinals, Giovanni Battista Re, bin lead Pope Francis burial service.
Di 91-year-old Italian dey ordained for di Diocese of Brescia for 1957. For 2001, Pope John Paul II proclaim am as cardinal.
Dem elect am as dean of di College of Cardinals for 2020, and Pope Francis extend im term for February dis year.
E participate for di Conclave of April 2005, wey elect Pope Benedict XVI and di Conclave of March 2013, wey elect Pope Francis.
Cardinal Giovanni bless di Pope coffin wit holy water, bifor burning incense in a thurible – dis na symbol of cleansing.
Di bells roll three times - at midday local time on di dot afta dem don carry out di blessing of di coffin.
Dem serve communion for pipo wey come di burial, including upstairs to di roof of di colonnade for journalists and photographers wey wish to take am.
Di communion rite na wia Catholics say di ritual show di togetherness of Christians and God.
According to Catholic belief, blessing di bread turn am into di body of Christ.

Wia dis foto come from, Reuters
Pope Francis become di first pope since Leo XIII, wey die for 1903, wey dem go bury outside di Vatican.
For im will, di late Pope request for simple grave for a niche along a side corridor of di basilica and go only just bear im Latin name, Franciscus.
Di late Pope say im wish na from im devotion to di Virgin Mary, mother of Jesus and im don visit di basilica 125 times during im papacy.
Pope Francis coffin bin move on di adapted popemobile as police sirens dey blow.
Wetin be popemobile?
Di Popemobile na di nickname wey dem give di high-security vehicle wey di pope dey travel in to meet well-wishers during official visits.
E dey specially designed to keep di pontiff safe, wit armour-plating on most of di vehicle and bullet-proof glass.
E get room for di pope to stand or sit for di back, and di seat dey raised so many pipo go fit see am. E also get seats for two of im aides.

Wia dis foto come from, Getty Images
For di procession through di streets of Rome wen dem wan bury di Pope, di back end of di popemobile bin dey adapted to carry im coffin.
Dem head through di streets of Rome towards di Santa Maria Maggiore Basilica, wia dem bury di Pope.
Wen dem dey carry di Pope to bury, dem pass through central Rome to Piazza Venezia, passing by di Colosseum, bifor dem come turn northward to arrive for Santa Maria Maggiore.
Three thousand volunteers dey stationed along di way to provide directions, medical help and water to pilgrims, according to local officials.
Di burial inside di church no dey open to di public, even as pipo gada for di church.
Inside, Catholics from all ova di world gada to pray and light candles in Pope Francis memory.
Families sit alongside nuns and priests as di atmosphere dey calm away from di chaos of di streets outside.
As dem don bury Pope Francis, e mark di beginning of a nine-day mourning period called Novemdiales, wit a mass wey go hold evriday in memory of Francis.
Mourning aside, di Catholic world attention go soon turn to di Conclave – di ritual selection of Francis successor wia eligible cardinals go gada for Vatican City to vote in secret.
Di cardinals neva confam a date yet, but di Conclave dey typically take place between 15 to 20 days afta di pope death.

Wia dis foto come from, Getty Images






