How Actress Ekene Umenwa react to video of her wedding reception wit Moses Bliss

Wia dis foto come from, Ekene Umenwa/Facebook
Plenty reactions don continue to follow one video wey show as Nollywood actress Ekene Umenwa take react wen gospel singer Moses Bliss show and perform for her wedding reception.
For di video wey dey trend and wey don turn hot topic for social media, di actress wey wed film maker Ifeanyi Alex during di weekend, bin dey wit her groom wen di singer show.
As she sight oga Bliss, wey be like surprise for her for di wedding reception, she no fit contain her joy. She dey overwhelmed, she kneel down, hug di gospel artiste as her husband and oda guests dey look on.
Di gospel artiste perform and hug her back.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Dis her action don divide social media as some netizens say na over joy and na only her know wetin she don go through, so di song dey touch her for body. Odas say na outright disrespect to her husband, how she go abandon am like dat on dia most important day.
Dem even say if na dem, dem go call off di wedding.
Moses Bliss no be di only gospel artiste wey turn up for dia wedding wey di actress kneel down as e dey perform.
Di actress also kneel down for joy wen anoda gospel artist, Ebuka songs turn up to do surprise performance for her wedding reception.
End of Di one wey oda users dey read well well
For di video she post on her Facebook page, she tok say di wedding na everytin she ever want.
However, few hours afta plenty debate on top dia wedding reception, di bride post for her Instagram page say, “It is sealed, officially a Mrs.” Di groom, Ifeanyi Alex also post say, “It is done, May di name of di Lord be praise.”
How social media users react
Social media still dey hot on top Nollywood celebrities wedding reception wey gospel artiste show give surprise performance.
Some social media users describe di Nollywood actress action as disgrace to her husband and if na dem e happun to, dat na di end of di marriage.
Dem question say if di role dey reversed, di woman go happy if na man do dat kain thing for female artiste?
Odas disagree, dem tok say na just happiness and dat na how she fit express am.

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter
Who be Ekene Umenwa?

Wia dis foto come from, Ekene Umenwa/Instagram
Ekene Umenwa na Nollywood actress wey dey popular for Igbo movies, she also dey do comedy ontop YouTube to entertain her fans.
On top her Instagram page, she describe herself as comedian, content creator and event planner.
Di Anambra state born actress bin dey act for school drama before she join di entertainment industry.
She don act for plenty feems wey include Terror in di kingdom, King afta kin among odas.
Who be Ifeanyi Ogbodo Alex?

Wia dis foto come from, Ifeanyi Alex/Instagram
Ifeanyi Alex na film maker. E also be di founder of First Nolly TV and di Kleanson Concept.
Di company don produce several movies wey feature plenty Nollywood stars.
According to im profile on Linkedin, e study for Caritas University, Enugu state, Nigeria and e describe imself as pesin wey be professional for im field of study.













