Phyna take back abortion statement

Josephina Otabor

Wia dis foto come from, Unusual Phyna/Facebook

One former Nigeria reality show winner, Josephina Otabor wey pipo sabi as Phyna don take back one controversial statement on abortion wey she tok wey make pipo para for social media.

Phyna wey be di winner of Big Brother Naija season 7 for one interview wit media personality, Chude Jideonwo bin tok wetin she feel about abortion.

For di interview, she bin tok say no woman go ever tok say she neva do abortion before.

She give dis informate afta she tok say she do abortion wen she dey young.

These her comment cause plenty tok-tok for social media, especially from women wey disagree wit her opinion.

However, di Level Up winner for her Instagram handle don take back di comment. She tok say, “Abortion no be wetin I stand for and I no want make pipo see me for dat light and I admit to all my mistakes.”

How di abortion mata take start

Months afta her interview wit Chude, Phyna bin kontinu to defend her view afta plenty pipo bin drag her on social media sake of her abortion comment.

She tok say all women, except virgins, do abortion. She claim say pregnancy prevention pills and oda measures to stop belle na all forms of abortion.

Di manner wey she take generalize di mata, no sit well wit her former BBNaija colleague, Princess Onyejekwe, she tok say make Phyna stop to dey label all women as abortionist.

Dis mata don cause katakata between di two housemates on social media and don generate plenty reactions.

However to quench di mata, Phyna don apologise for di statement. She say she no mean am dat way and wetin she tok na for di heat of di interview.

“I no go ever encourage abortion especially no be for dis part of di world, wia e fit pose great threat to di life of pesin wit di illegal and unhealthy procedures wey surround am.”

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Di reality show star tok say she don dey work wit gender-based organizations to provide sensitization and education give young girls on abortion.

Who be Josephina Otabor

Phyna wey her real name na Ijeoma Josephina Otabor win di 2022 edition of Nigeria reality show, Big Brother Naija.

Di 26 year old entrepreneur bin beat 23 oda housemates to emerge winner of di show tagged, ‘Level up’.

Phyna win di grand prize of 100 million naira - N50m cash and N50m worth of gifts from di sponsors.

She dey describe her sef as pesin wey no like to keep malice even though she agree say her temper no good.

Di reality TV star wey come from Edo State, south-south Nigeria, na actress.

She be first class graduate of Engineering from Auchi Polytechnic, Edo State.

Phyna say she also dey do hype-woman for clubs.