Politicians wey dey arrange dem sef to comot Paul Biya as Cameroon president for 2025

As we dey move comot from di Cameroon 2018 presidential election wey di candidate wey come second bin contest, and as we dey move closer to di one for 2025, many changes dey occur for di political scene.
Dis changes fit decide wetin go happun for di upcoming election.
Cabral Libii, congress under complain
Di candidate wey come number three position for di last presidential election no see peace for sure wit di kain events wey dey occur dis days.
Di Cameroon Party for National Reconciliation (PCRN), wey im bin don dey lead since July 2019, bin dey prepare to organise congress from December 15 to 17, wit di mind say dem go “refine preparations for future electoral battles,” Cabral Libii tell tori pipo.
But dis plan no succeed, di party bin get notice say di sub-prefect of di second district of di seaside town of Kibri for south of di kontri wia dem suppose do di meeting, do u-turn, reverse im decision and forbid dem from doing di meeting wey im bin give dem permission to do some just few days ago.
Reason wey di authority bin give be say, dis na “internal conflicts inside dis party, wey fit seriously disturb public order”, we fit read am for di document.
Di political party don dey go through palava for some time now and dis get connection to am.
Di current president of di party, Cabral Libiigo show before di Kaélé court of first instance for di far North of di kontri on January 4.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di judge order am to show afta one complain from Robert Kona, one of di founders of di PCRN, wey bin lead am till July 2019, before e pass di baton to Cabral Libii and become honorary president, and first advisor to Libii.
Relationship between am and di current president, don pafuka.
"E no dey pick my call again, im dey make decisions alone witout consulting me, e don turn authoritarian" Robert Kona tell BBC Africa.
However “di constitution say im must consult me before making any decisions”, im explain, before concluding “I want am to hand over di party to me”.

Wia dis foto come from, PAGE FACEBOOK CABRAL LIBII
Cabral Libii reject dis statement. Instead wetin im dey more concern about na di reason wey make dem ban im congress, wey im say “don already register more dan 1,500 voluntary participants”.
According to am, “e no get any need to worry, unto say di accusations of authoritarian excesses wey dem mention dey come from one pesin”, im explain for telephone.
“Di pesin wey you dey tok about, I no understand im real motivations. Sometimes e dey authoritarian, sometimes I no dey report to am, sometimes I no dey consult am. In any case, I dey calm, I go show for court, and I go give arguments wey go show say no be my fault,” e explain.
Cabral Libii, 43, don first break up wit one political party wia im bin be partner. Dis na di Univers party, wey present am as dia candidate for 2018 presidential election.
But few months afta di presidential election, kasala burst between di candidate wey come number three position and di president of “Univers” party, wey bin ask am to account for how im take manage di money for di presidential election wey im just finish.
Now, e go pay attention to how di Kaélé trial between Libii and di founder of PCRN go take finish, becos di party na good guarantee say im go fit participate for di next presidential election for di Nyong Ekélé deputy.
Especially since e be say dis political group bin participate for di last legislative and municipal elections and win 5 seats for National Assembly, 7 municipalities, and more dan 200 municipal councilors.
Court decision against am fit put di so-called “Cameroon Macron” for unfavourable ballot, for di presidential election.
Maurice Kamto hope for locals before di presidential election
Maurice Kamto come second for di 2018 presidential election, wia im claim say im win against President Paul Biya, wey don dey since 1982.
However, dis 69 year old opponent wey be di former minister for justice, dey face risk of say im no go be candidate for di 2025 presidential election.
Di reason? Im party, di Movement for di Renaissance of Cameroon (MRC) refuse to participate for di 2020 legislative and municipal elections, as dem condemn “one electoral hold-up” during preparation.
Dis absence from di last legislative elections na serious compromise for im chance to participate for di presidential election, since MRC wey im dey lead no get representatives throughout di kontri.
But we go see weda im go decide to do alliance wit anoda political party, or weda im go choose di option of sponsorships.
But so far, di opponent don try to give assurance about im participation for di presidential election, and im dey demand make dem do new legislative and municipal elections, before di presidential election.
Di kontri elect dia deputies and municipal councillors for February 2020 and dem get mandate of 5 years. Diafore, dis option mean say going to di ballots go happun around di month of February 2025.
We must still take account of di fact say for di history of Cameroon, since di return of multi-party system for 1990, di kontri neva ever do municipal and presidential legislative elections for di same year, except for di legislative elections of 1997, wey dem do separately from municipal elections.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem postpone di last two combined legislative and municipal elections for 2012.
Dis na to give Elécam, election body wey dem recently establish for di kontri time to balance and gada material and financial resources.
For 2018, dem postpone di election for one year for July, but finally do am for February 2020, at di request of di Presidency of di Republic.
Di explanation wey dem give deputies be say: "Holding of presidential, legislative and municipal elections at approximately di same periods for 2018 go make organisation of materia difficult sake of overlap of electoral operations."
In di meantime, di Movement for di Renaissance of Cameroon party dey plan to organise one convention on December 9 and 10 for Yaoundé convention centre.

Inside six months, dem don don exclude two dangerous opponents of dis candidacy.
Dem be Me Michèle Ndoki, wey wit clear eye Maurice Kamto to “execute di departure play” and make im no run, and make im denounce di “plenty resignations inside party.”
Dem exclude di 50-year-old lawyer last July for “refusing to agree to di political line and discipline of di party”, according to di party decision.
For her, e bin be logical sequence of events, since “di purpose of my exclusion na to prevent my candidacy… I dey excluded becos I decide to rebel against di recovery of di party wey dey service one man, and im ambitions,” she tell private Cameroon television, as she dey react to her exclusion for sure from di political party.
In addition to dis exclusions, several party activists don resign, and several of im senior activists, like di party treasurer, di academic Alain Fogue, and even Kamto tok tok pesin wey bin dey prison for 7 years.
Authorities bin arrest am wit many oda activists, dem convict dem of “rebellion and attempted insurrection” afta dm try to organise one peaceful march for 2020, against di goment.
Franck Biya, CPDM 2025, afta or neva?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di na di new element witin di ruling party.
Franck Biya, eldest son of Cameroon president, Paul Biya, recently take di card of di party wey im papa don dey lead since dem create am for 1985.
At 52 years old, tori of im presidential ambition don dey go on for several years, even though im imsef no ever tok about di mata.
But suspicion full everiwia, as Cameroon pipo dey see di businessman wey dey operate for di logging section dey show for public either for party uniforms, or during social events as e bin occur few years ago, during di Mbankollo landslide for Yaoundé.
Wen for one occasion of di 38th anniversary of di CPDM, on November 6, Franck Biya give one speech wia im call im papa "natural leader of di party" and request di right of reserve on political subjects.
Im collect di party membership card, e go make am likely presidential candidate on behalf of di ruling party?
For now, we no fit tok wetin we no see, we go certainly gatz wait for di party congress, wey no dey organised since 2011.
Na around dis time dem dey assign di president of di party, di only person capable of representing "di party of di torch" during presidential election, and currently, na Paul Biya, wey don dey dis position since di creation of di party, 38 years ago.













